179 pipo die for South Korea worst plane crash

Wetin we call dis Video, Footage show moments afta fatal plane crash for South Korea
    • Author, George Wright
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

One plane wey carry 181 passengers don crash for one airport for South Korea.

All di 175 pipo wey dey on board plus four crew members die for di plane crash, authorities confam.

Only two crew members survive di crash and dem dey receive treatment for hospital.

Di Boeing 737-800 flight wey Jeju Air dey operate bin carry 175 passengers and six crew members, and dey return from Bangkok for Thailand and crash as e dey land.

Di plane bin comot from di runway and crash inside one wall for di Muan International Airport for di south west of di kontri, di Yonhap news agency report.

Di passengers on board di flight include 173 South Koreans and two Thais, Yonhap report.

Authorities dey investigate di cause of di crash, however fire officials tok say e fit be bird strike and bad weather cause am.

Meanwhile, goment don declare a period of national mourning for di kontri for di next seven days.

Dem go low down flags for goment offices and civil servants go wear black ribbons.

Part of one plane catch fire next to di runway

Wia dis foto come from, Reuters/Yonhap

Unverified footage wey dem upload for social media of di crash - wey happun shortly afta 09:00 local time (00:00 GMT) - show as di aircraft skid off di runway and crash enta one wall, bifor some part burst into flames.

Oda footage show as one large plume of black smoke dey rise go di sky.

Ova 1,500 emergency personnel don dey deployed for di recovery effort, including 490 fire employees and 455 police officers.

Eye-witnesses wey follow South Korea Yonhap news agency tok say dem see sparks and hear explosion bifor di crash.

Yoo Jae-yong, 41, wey dey live near di airport, tell Yonhap say im see spark on di right wing bifor di crash.

Kim Yong-cheol, 70, tell di agency say di plane bin fail to land initially and e circle back to try again.

Kim say im see "black smoke dey go di sky" afta e hear one "loud explosion".

"I see di plane dey come down and I tink say e wan land, wen I notice a flash of light," anoda witness named Cho add. "Then one loud bang followed by smoke in di air, and then I hear series of explosions."

Acting South Korean president, Jeju Air and Boeing 737 express condolence

Choi Sang-mok wey become acting president on Friday tok sorry to di families of di victims

Wia dis foto come from, EPA

Acting South Korean President Choi Sang-mok say im go do all im fit do to support di bereaved families.

Oga Choi wey just assume leadership of di kontri on Friday bin visit di site of di crash and e express im condolence to families of di victims.

E direct di goment to use all equipment and personnel available to rescue as many pipo as possible from di Jeju Air crash site.

"We get grave situation where a great loss of life occur afta one plane comot di runway for Muan airport," e tok.

Meanwhile, Di CEO of Jeju Air don publicly apologise to di victims of di crash.

For one short media briefing, Kim E-bae and oda company bosses bow dia heads. E say supporting di bereaved na dia top priority for now.

Earlier di airline bin change dia website to black and published one apology online.

Also, plane manufacturer Boeing don offer dia condolences and dem say dem dey in touch wit South Korea Jeju Air afta di deadly crash.

Families of di plane crash victims gada for di airport

Wia dis foto come from, Reuters

Relatives of those wey die for di crash don gada for di airport.

Dem dey frustrated say di identification dey take long time. One official tell di crowd say some of di passengers na underage, wey mean say dem no carry ID, and dat make di identification a challenge.

Meanwhile, for inside di terminal, di airport authorities and di Red Cross don set up more dan one dozen yellow tents for di bereaved families to find privacy.

Dem don give each family wool blankets to keep dia body warm or sit on for di hall.

Map showing Muan

Muan dey about 178 miles (288 km) south of di capital, Seoul.

Many pipo consider South Korea aviation industry to get solid track record for safety.

Dis crash na di first fatal accident for di history of Jeju Air, one of South Korea largest low-cost airlines, wey dem set up for 2005.

Dis na also di first fatal crash wey go happun for South Korean airline for ova a decade.

For 2013, three pipo die wen one Asiana Airlines flight crash as e dey land for San Francisco.