Nafdac warn against alleged fake birth contraceptive

Birth control pills

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (Nafdac) don raise alarm say fake Postinor-2 (Levonorgestrel 0.75mg), one emergency contraceptive pill, don full market for Nigeria.

Di agency for one statement dem issue on dia official X account on Tuesday, 26 August declare di Type 1 and Type 2 batches of Postinor-2 as fake.

Dis na afta di Society for Family Health (SFH), di authorised importer of di pill, confam say no be dem import di products to di West African nation.

Di manufacturer of di product neva publicly comment on di mata.

Although, Nafdac no tok how long these fake Postinor-2 don dey circulate for Nigeria, however, dem say dem dey investigate di source of di fake products.

"All Nafdac zonal directors and state coordinators don dey directed to carry out surveillance and clear di product of type 1 and 2 Postinor 2 (Levonorgestrel 0.75mg) within di zones and states," di agency tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

How to spot fake Postinor-2

Birth control pill

Wia dis foto come from, Getty Images

Di food and control agency give kontri pipo tips on how to differentiate between di fake Postinor-2 and di original one.

According to Nafdac, na three ways dey to identify fake Postinor-2 and di original, and na from dia pack you go know.

  • Font size: Di PIN verification sticker for di pack of di fake Postinor-2 get smaller font size, while di original sticker dey use larger, clearer font.
  • Wrong spellings: For di fake product, dem spell di word Veify instead of Verify. Dem also spell di word Distnibuted instead of distributed for di pills dem dey sell for Nigeria.
  • Batch No: Di batch number too dey different. For di fake product, di Batch number for di Type 1 Batch No: T36184B and dat of Type 2 na 332. Meanwhile, for di original product, di Batch N0: na T32458H

Nafdac advise distributors, retailers, healthcare professionals, and caregivers to dey careful and vigilant in di supply chain to prevent di distribution, sale, and use of falsified products.

"All medical products must be obtained from authorized/licensed suppliers. Dem must check products' authenticity and physical condition carefully."

Health risks of fake Postinor-2

Fake and original postinor 2

Wia dis foto come from, Nafdac/X

Di food and drug control body say sake of di possible presence of harmful or substandard ingredients, incorrect dosages of levonorgestrel, and unsafe manufacturing practices of falsified Postinor-2 (Levonorgestrel 0.75mg) na serious risks to individual health and public safety.

Di risk wey dey involved in taking di fake contraceptive pill include:

  • Failure of contraceptive effect, dis one mean say if you use am, e no go work.
  • Toxic contamination
  • Unpredictable side effects
  • Delayed or missed access to genuine emergency contraception, and long-term reproductive health complications.

Counterfeit medicines fit also contain unknown substances wey fit cause allergic reactions, organ damage, or even death, Nafdac warn.

Wetin be Postinor-2 and wetin dem dey use am for

Postinor-2 na emergency contraceptive pill only. Postinor-2 no be di regular method of birth control.

Dem dey use am prevent pregnancy wen pesin take am within 72 hours of unprotected sexual intercourse.

E dey estimated say Postinor-2 go prevent 85% chances of expected pregnancies.

E get 95% chance to prevent expected pregnancies if you take am within di first 24 hours, di chances go reduce to 58% if you take am between 48 hours and 72 hours afta unprotected intercourse, NPS Medicine Wise tok.

Sabi pipo neva know if Postinor-2 dey effective if pesin take am more dan 72 hours afta unprotected intercourse.