South African influencer tok sorry ova viral Russian job videos

Wia dis foto come from, Gallo Images/Getty Images
- Author, Mayeni Jones
- Role, BBC News in Johannesburg
- Read am in 5 mins
One South African influencer wey dey linked to one controversial job scheme for Russia don tok sorry for her role in promoting di scheme for kontri wia many young pipo dey desperate to find jobs.
Cyan Boujee, wey her real name be Honour Zuma, bin come under fire afta one of di videos wey she post online to advertise jobs for women aged between 18 and 22 bin go viral.
Dis make di govment to sama warning about di scheme and alert pipo say di job no pure, and dem tok di dangers of human trafficking and "unverified job opportunities overseas".
"Immediately wen I see di comments on my stories and on my videos… I know say dis no be something wey I stand wit," di 24-year-old tell her 902,000 followers on Instagram.

Wia dis foto come from, Cyan Boujee/TikTok
For her Instagram apology, Cyan agree say "human trafficking na very, very serious mata", she add say di reaction wey she don get na "huge learning curve" for her and "and all di oda influencers".
"I know say dis na something I gatz delete immediately, I no care about di money," she tok.
"I apologise and I believe say dis na something wey no go ever repeat imsef again."
Dis job videos wahala bin cause gbasgbos on social media as pipo launch petition and call on influencers to instead use dia platforms to "spread awareness about di signs and dangers of trafficking".
Di influencer wey dey popular known as Cyan don remove di promotional videos from her social media pages.
Di job bin dey described as opportunity for a "fresh new start" for young women at the start of their careers.
For Boujee video – wey dem shoot for Tatarstan for Russia – dem show viewers di accommodation wey di pipo wey dem employ go dey stay.
Di influencer, wey her real name na Honour Zuma, describe di programme as "fresh new start" she add say "clearly dem dey treat girls fairly for here – Africans, Asians, Latin Americans".
Boujee, wey get 1.7 million TikTok followers, also explain say those wey dem hire go get jobs and dem go teach dem how to speak Russian.
E neva clear di work wey di young women go dey do, but di programme wey she advise target women aged 18 to 22.
Suggestion no dey say Boujee don do anything illegal, she also neva respond directly to di criticism wey she face ova di weekend.
Viral online videos wey promise jobs for Russia - South Africa govment warn women
South Africa govment on Tuesday warn young women say make dem no fall for social media recruitment scam wey dey promote job opportunities for abroad.
Dis dey come as plenty online videos wey South African social media influencers dey push to advertise jobs for young women for Russia don go viral.
Di authorities dey torchlight one promotional video wey one influencer Cyan Boujee promote, she don comot di video now from her account. She bin describe two-year "start programme" for young women for di beginning of dia careers wey wan get professional skills.
Plenty young pipo for South Africa dey jobless and many of dem dey desperate for work.
Di South African government dey "extremely worried" to see as dem dey use influencers to promote jobs abroad, according to di kontri head of public diplomacy Clayson Monyela.
For one X post, e warn young pipo, especially girls, "say make dem no fall for unverified foreign job offers", especially di ones dem dey promote on social media.
"If something look too good to be true, get a 2nd opinion," e write.
Authorities bin launch investigation into di scheme. Deputy Justice Minister Andries Nel tok say "so-called opportunities" most times dey "linked to serious risks of labour exploitation and human trafficking".
"No ever rely solely on social media promotions or unsolicited social media advertisements, always cross-check and verify job opportunities through official channels," e tok on Wednesday, 27 August.
One of di main recruiters for di scheme wey Cyan and oda influencers bin dey promote na one special economic zone for Tatarstan, wia believe dey say dem dey produce weapons.
Allegations don dey ground say some pipo wey dem recruit to go work for Tatarstan bin end up working in a weapons factory, wia dem dey make drones wey dem dey use for di Russia war in Ukraine.
One of di main recruiters na one special economic zone for Tatarstan, wey be wia pipo believe say dem dey produce these weapons.
One report by di Global Initiative Against Transnational Organized Crime wey dem release for May bin chook eye into di recruitment of pipo for di "start" programme.
Dem tok say di "dem dey entice potential recruits to participate under false pretences on top di nature of di work, di working conditions and opportunities for education", e add say di objective na to support di "drone production programme".
Most of dem dey work "directly in drone production, while odas dey work as support staff – cleaners and caterers".










