Authorities suspend train operations on Abuja-Kaduna rail line afta accident wey happun, give update on di 618 passengers

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria Railway Corporation don give update say na 618 pesins dey inside di Abuja-Kaduna train wey fall comot for di rail line on Tuesday.
According to di statement from di managing director of di railway corporation, Kayode Opeifa, e say di Abuja-Kaduna train service don dey suspended sake of dis incident.
E also add say dem regret any inconvenience wey di incident go don cause both passengers and pipo wey wan use di train travel.
Na on Tuesday di Abuja-Kaduna train bin derail comot for track wit passengers inside and dis don raise serious concerns among Nigerians.
For inside di train wey derail, na 618 pesins dey dia wey include 583 passengers, 15 NRC crew members, one medical personnel, eight cleaners, and 11 catering staff.
Di railway corporation say dem comot all di pipo wey dey inside di train wen e derail.
"Out of dat number, seven passengers bin sustain different degrees of injuries and dem immediately transport dem by ambulances go hospital", di railway authority tok for dia statement.
Di authority also add say dem don direct all third parties and ticketing company make dem make "refund to all passengers wey dey on onboard for di affected service."
Wetin happun for di Abuja-Kaduna train bifor
Di Nigerian Railway Corporation (NRC) bin suspend train operations on di Abuja-Kaduna route till further notice.
Kayode Opeifa, wey be di managing director of di NRC tok dis one wen e dey tok wit tori pipo for Abuja, afta di accident.
E say some technical staff of di corporation, di Nigeria Safety Investigation Bureau (NSIB) and odas dey for wia di train derailment happun to torchlight di mata.
Opeifa add say no be true say di trains no dey in good condition.
Earlier, President Bola Tinubu tok sorry to di passengers wey dey involved for di Abuja-Kaduna train wey get accident on Tuesday, 26 August.
Di Nigeria leader wey dey far away Brazil for bilateral relations on im official X account post say im dey" deeply saddened by di incident" and im dey wait for full briefing to ensure swift action and support for all di pipo wey dey affected.
E tok dis one as di Nigeria Railway Corporation (NRC) confam say one train wey carry passengers from Abuja dey go Kaduna State, northern Nigeria bin fall comot from rail line around 11:09am for Kilometre 49 between Kubwa station and Asham station.
Oga Tinubu give assurance say NRC don already dey address di situation, and dem dey take di necessary steps to prevent similar incidents for di future.
"My heartfelt prayers dey wit di injured, dia families, and all passengers wey go through dis distressing experience," Oga Tinubu tok.

Wia dis foto come from, Screenshot/NTA/X
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
One viral video wey dey go upandan show as passengers wey bin dey travel wit di train from Abuja to Kaduna stand for different parts of di rail track.
Di video also show as some of di coaches for di train turn upside down along di Kaduna corridor.
According to reports, pipo wey see as e bin happun describe am as chaotic as passengers dey try to run to safety as dem dey confused and no know wetin bin dey really happun.
Authorities neva tok wetin really cause di train to fall comot from di track.
Di railways for Nigeria dey relatively safe apart from attacks wey bin happun for 2022 wen jaguda pipo bin attack one train wey bin dey go Kauna and kidnap di passengers.
One train attack bin also happun for 2023 wen jaguda pipo also kidnap passengers for Edo State, south-south Nigeria.
Ova 150 pipo bin miss and at least eight pipo bin die.
But for dis recent train mata, nobodi die.










