Police confam release of medical doctors, odas wey jaguda pipo kidnap

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria Police don confam say di twenty medical students and oda pipo wey jaguda pipo bin kidnap for Benue State don regain dia freedom.
Tori about di kidnap of di students wey bin dey travel for one religious programme show face for social media last week Friday.
For statement wey Nigeria Police Force headquaters tok-tok pesin, Muyiwa Adejobi release on Saturday, im tok say di jaguda pipo bin hold di victims for Ntunkon forest, Ado Local Goment Area of Benue state.
Na on Friday di office of di National Security Adviser rescue di victims witout payment of ransom.
"We confam di release of our brodas and sisters and some oda Nigerians wey bin dey captivity on Friday 23rd August 2024 for Ntunkon forest, Benue State. We no pay any ransom.
Police add for di statement say even though some tweets and unconfirmed tori dey fly upandan say dem pay moni, dem no pay anytin.
"Contrary to some tweets and tori dem wey pipo neva confam, tori say we pay some money no correct, we no pay any kobo to release dem.
Oga Muyiwa explain say na security tactics dem use rescue dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
" We actually rescue dem tactically and professionally. We commend di security agencies, locals, and di Office of di National Security Adviser for dia commitment and resilience."
Im tok say dem go give more details soon.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Wetin bin happun?
On Thursday 15 August, 2024 medical students and some doctors bin dey travel go one medical convention bifor jaguda pipo kidnap dem for road.
Di tori wey spread on Friday make Nigerian para as dem bin chook mouth for di mata sake of dem no support di series of kidnappings for di kontri.
According to local media report di jaguda pipo bin contact family members of di victims.
Dem ask for ₦50 million naira ransom bifor dem go fit release di medical students and doctors.
Di Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun, sake of plenti tok-tok and dragging for di social media give order to rescue of di victims.
For statement Police tok-tok pesin, Olumiyiwa Adejobi, bin tok say di IGP condemn di kidnapping of di medical students.
Oga Egbetokun bin describe di kidnapping as wetin “no good at all, callous, and no dey acceptable”.
“Sake of our unwavering commitment to di rescue, safety, and well-being of di young Nigerians, di IGP don order sharp sharp deployment of one substantial number of human and technical resources to support di manpower of di Benue State Command and make sure say dem rescue our beloved students.
Dis initiative go get mobilization of additional tactical units from di FID-STS and FID-IRT, di deployment of advanced helicopters and drones, and di use of specialized tactical vehicles to facilitate di search and make sure say di victims come back safe.
“Di Nigeria Police Force stand wit di victims and dia loved ones during di challenging time, and we dey committed to make sure say dem come back safe"
Im bin also promise to pursue di jaguda pipo and odas wey get hand inside including oda cases too.
Im add say di Nigeria Police dey determined to fight against crimes and criminality, most especially kidnapping of Nigerians.
Even wit dis news Nigerians for social media still dey ask more kwesions
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5
Kidnapping na one of di biggest security challenges for Nigeria, e don tey wey e start and goment afta goment dey promise to tackle dis challenge.
Jaguda pipo for Nigeria no dey select who dem dey kidnap again, now dem dey kidnap anybodi and dis dey put fear for citizens bodi especially pipo wey dey travel by road.