Ogbonge gospel singer Aduke Gold make her final journey home

Wia dis foto come from, Instagram/adukegold1
Di bodi of ogbonge gospel singer Aduke Ajayi wey many sabi as Aduke Gold bin dey laid to rest as friends and families pay dia last respect.
Wit tears, sad mood and cloudy weather, dem carry di bodi of Aduke Gold to wia dem bury her for Ikorodu area of Lagos on Friday 23 August, 2024.
Di death of Aduke Gold bin shake di music industry and her fans for Nigeria.
Monday 12 August, 2024 enta wit tears and sad mood for many gospel singers and fans of Aduke Gold wen di news of her death bin spread.
Aduke elder broda Pastor Ajayi Aderounmu tell BBC say na cervical cancer kill di gospel singer.
"Regarding Aduke death, na cervical cancer kill am, becos e appear for her death certificate," Pastor Aderounmu tok.
Di death don cause pain for many wey no expect say she go die so early sake of say dem no suspect say she dey battle any sickness.

Wia dis foto come from, Instagram/adukegold1
One of di close friends to Aduke Gold na di superstar Tope Alabi wey many gospel musicians take as mentor.
Di death of Aduke bin shock her becos dem be friends from di beginning.
"Aduke, you know say I love you, but Jesus love you more. Rest in perfect peace, "dis na wetin Tope Alabi write for her Instagram page.
Anoda ogbonge gospel singer Esther Igbekele mourn di death of Aduke Gold as she remember how dem take start togeda.
"You bin start veri young as Aduke Penkele to grow big to Aduke Gold. But today you no dey again. Heaven don gain one angel. Sleep on dearest sister,"Igbekele write.
Tori of how Aduke bin die still dey surprise some pipo but di hospital wia she die tok say treatment bin dey go well bifor she die.
Dem rush Aduke go hospital and tok-tok pesin for UCH Funmilayo Adetuyibi bin tell BBC say na dia hospital Aduke Gold die.
She add say dem bin refer Aduke Gold to UCH from Olabisi Onabanjo Teaching Hospital for Ogun State on 3 August.
Na for wia she bin dey do diagnosis for di hospital she bin die, UCH tok-tok pesin tell BBC.
How dem bury Aduke Gold

According to many pipo, Aduke Gold na veri happy and lively pesin wey don use her music help di life of pipo.
Di gospel singer don sing for plenti churches for Nigeria and also collabo wit plenti fellow singers for di Christian space.
Friday 23 August, 2024 no go be like evri oda day for di fans of di ogbonge gospel singer as dem come out to pay her last respect.
At di Lagos African Church Grammar School, dem bring di bodi of Aduke inside a white branded vehicle wit her coffin wey also dey white.
Fans and families begin dey cry as dem dey carry di bodi comot for di vehicle.
Dem first do service of songs for di late singer wit church member and families singing wit tears for dia eyes.
Meanwhile, na Wednesday, 21 August dem begin di burial program wit candlelight procession in her honour.
On dat day, wit candle and black clothes, fans and lovers of di late singer bin cry out dia eyes as some dey tok tins wey she don do.
For Thursday, 22 August, plenti fellow gospel singers organise music night for her. Dis na dia own way to honour dia friends wey don pass on to glory.
Sadly, during di burial ceremony of late Aduke Gold, dem announce she get song wey she bin wan release bifor she die and she also get house wey she neva complete.
Her death bin come just two weeks bifor di release of her new song.
Dem place di bodi of Aduke Gold for wia pipo go fit waka pass to look her bifor dem bury her.
Na tears bin follow as pipo begin dey look her coffin as dem dey carry am go bury.
Di bodi of Aduke Gold touch down for Ikorodu wia dem bury her as pipo pay dia last respect.

Wia dis foto come from, Instagram/adukegold1
How Aduke Gold take rise
Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold for 1990 for Ilesha, Osun State, southwest Nigeria.
Aduke Gold bin lose both her parents wen she dey four years old and she live for her elder broda house for some years.
Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.
Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for Youth Affairs and Sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.
She graduate from Lagos State University wit degree for International Relations.
Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.
Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.
On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world afta she battle sickness wey she no survive.
Pictures from di burial













