Family of Aduke Gold release burial arrangements for late singer

Wia dis foto come from, ADUKEGOLD1/INSTAGRAM
Family of gospel singer Aduke Ajayi aka Gold don release burial arrangements for di late singer wey breathe her last on Monday, 12 August.
Dis dey come afta Aduke elder broda Pastor Ajayi Aderounmu tell BBC say na cervical cancer kill di gospel singer.
Na Esther Igbekele wey also be gospel singer break di news of Aduke death through her Instagram page.
"Regarding Aduke death, cervical cancer kill am, becos e appear for her death certificate," Pastor Aderounmu tok.
Pastor Aderounmu say Aduke bin dey stay for im place bifor and comot about five years ago.
E say Aduke bin call am three weeks ago and she no sound like pesin wey sick.
Pastor Aderounmu tok say na on Monday wey Aduke die im first hear say she bin dey sick.
Earlier, di University College Hospital (UCH) Ibadan don react to di death of popular gospel singer afta one video bin trend on social media wia one man bin tok say "finally, UCH release Aduke bodi afta several hours of shouting, screaming, dem finally release am".
Burial arrangements for Duke Gold
Pastor Ajayi tok say di Ajayi's family bin meet wit Gospel Musicians' Association of Nigeria (GOMAN), and dose di mata affect.
E tok say dem go bury Aduke on Friday, 23 August 2024.
Pastor Aderounmu tok say di candlelight procession go first take place on Wednesday, 21 August August.
E say artistes night go take place on Thursday, 22 August 2024, and add say di program go start by 6pm to 6am.
For di obituary wey di family release, di candlelight procession go take place for Ayanfe Primary School for Idiagbon Bus Stop, College Road, Ifako-Ijaiye, for Ogba area of Lagos State.
Artistes night go shele for di same address wey di candlelight go take place.
Lying in state go happun for Lagos African Church Grammar School, College Bus Stop, College Road, Ifako-Ijaiye for Ogba.
Who be Aduke Gold?

Wia dis foto come from, ADUKEGOLD1/INSTAGRAM
Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold, for 1990 for Ilesha, Osun State.
Aduke Ajayi bin lose both her parents wen she dey four years old.
Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.
Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for youth affairs and sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.
And she graduate for Lagos State University wit degree for International Relations.
Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.
Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.
On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world.










