Why police arrest Mr Ibu son, adopted daughter

Wia dis foto come from, Mr Ibu/Instagram
Nigerian police don arrest di son and adopted daughter of popular Nigerian comic actor John Okafor, wey pipo sabi as Mr Ibu, over allegations say dem tiff money wey suppose be for di actor treatment.
Onyeabuchi Okafor and Jasmine Okekeagwu dey alleged to “collect di actor phone and hack im banking details", bifor dem tiff 55m naira ($60,700; £47,800).
Di money na part of funds wey fans and well-wishers donate for di actor treatment, afta e suffer one long illness last year.
Di sickness lead to di amputation of one of Okafor legs. Di Nollywood star also undergo five surgical procedures, im family tok.
“Authorities don recover 50m naira, local media tok, quoting di tok-tok pesin of di police criminal investigation department, Mayegun Aminat.
Di two suspects dey plan to escape to di UK, according to Madam Aminat.
Police also say dem don recover di N50 million – and dem don charge di two suspects go court on top alleged conspiracy and stealing for di Chief Magistrate’s Court 1, Yaba.
Di court also grant dem bail and adjourn di matter to 11 March 2024.
End of Di one wey oda users dey read well well
For one video wey bin spread on top social media for October 2023, di actor dey beg im fans to pray for am.
Di actor say im don dey hospital for sometime sake of one "strange and dangerous illness”.
E say doctors don recommend make dem cut im legs.
“As I dey speak to you, I still dey lie down for hospital; di medical director of dis hospital say di best solution be say, in case im new idea no work, di best idea na to cut off my leg”, e tok for di sick bed wit im wife and daughter dia.
Mr Ibu further tok say make im fans tok to God as im no wan make dem cut im legs.
On Saturday, 16 December, tori bin spread say di actor health dey deteriorate plus doctors don amputate im second leg.
Some local media bin report say di President of di Actors Guild of Nigeria (AGN), Emeka Rollas tell tori pipo say Mr Ibu don undergo anoda leg amputation and e no fit tok.
However one member of im family Valentine Okafor for one post on di actor Instagram page don set di record straight on Mr Ibu health.
Ms Okafor post say dem no amputate Mr Ibu second leg but na dat first leg wey dem cut doctors bin work on again.












