Wetin we know about hijack of two passenger buses by gunmen for Kogi

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Kogi State Police command don confam di tori wey dey spread for social on about how gunmen take hijack two passenger buses for Kogi State to BBC News Pidgin.
Tori be say di buses comot from Umuahia, di Abia State Capital, dey go Abuja, but gunmen catch dem for road around Lokoja, Kogi State, march all di passengers enta bush.
According to di tori, di buses belong to God is Good Motors, and ABC Transport Company.
One person for X - formerly known as Twitter - wey im name na Chude Nnamdi, tok how one man wey be husband to one of di passengers for di bus take reach out to am tell am say "di kidnappers call me dis morning wit my wife phone".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Tok tok person of police for Kogi State, William Ovye Aya, tell BBC News Pidgin for phone interview say di tin happun true true, but dem neva sure di actual number of pipo wey di gunmen kidnap.
Aya tok say: "We get di report about di kidnapping, but we no know weda na all di passengers for di bus bin dey kidnapped.
"Wen we get di report, di DPO of dat area mobilise im men plus including local vigilantes and hunters, dem enter di bush and dem don dey comb di bush make dem rescue di victims.
"Meanwhile, di komishona of police for Kogi State, CP Bethrand Onuoha, don also deploy additional tactical squad, wey comprise of di quick response unit, police mobile force, counter terrorising unit, and conventional police, to join hands wit di team for ground make dem rescue di victims."
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Pidgin reach out to God is Good Motors, and one tok tok person for di company wey no mention im name, confam say di attack happen true true.
"We dey try to get more information, and when we get am we go get back to you," di person tok.
But im no come give details about di attack, how many pipo dey di bus, or whether di kidnappers don reach out to di company to make any demand.
Similarly, di person wey answer di call for ABC transport also tok say dem never get details of wetin happen, but im no confirm or deny whether di attack happen true true.
Di Ajaokuta, Okene and Lokoja axis of Kogi State don dey popular for violent attacks on road passengers, and kidnapping for ransom don dey on di rise for Nigeria now.
For December 30, 2023, di police tok say dem rescue 21 passengers wey gunmen bin kidnap along Ajaokuta – Itobe road two days earlier.
Nigerians for social media wey chook mouth for this recent attack no fit understand why goment neva wan take urgent action for di incessant kidnapping for Kogi state roads.














