Simple tins to improve your personal security for Nigeria

Kidnapping in Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Di way jaguda pipo dey kidnap pipo pipo nowadays for Nigeria dey make many pipo fear.

Security situation across di kontri dey very bad.

Dis Jaguda pipo wey dey criminal gangs don gbab hundreds of pipo in recent years.

Dem dey see am as an easy way to make money. E dey really bad especially for di north-west part of di kontri.

Many pipo now dey very security conscious becos of all di incidence wey don dey happun.

Early dis week, Jaguda pipo gbab nine pipo for Ekiti state, south west of di kontri.

Di victims neva regain dia freedom, five of dem na students while four na staff all of dem na from di Apostolic Faith Group of Schools.

Di proprietor, Gabriel Adesanya say di kidnappers dey demand for 100 million Naira, dat na ova $111,000 before dem go release dem.

"Many of di parents no fit even afford one-tenth of di money. Na bad situation for di school and di community’’. Gabriel Adesanya tok.

We neva fit resume classes since di attack." Adesanya add.

One of di students wey bin dey di bus during di attack, tell BBC News tok how di incident happun.

According to di student e say di incident happun afta school close.

"We hear gunshots three times and our driver stop to check di bus tyres. Di gunmen capture am and threaten us say if anyone try anytin funny, dem go kill am. Di eye witness tok.

President Bola Tinubu don order for di immediate rescue of di victims, and add say dis kain tin no go happun again.

Many pipo dey ask how you dem fit improve dia personal security?

Di answer to dat kwesion dey inside dis tori.

We go share tips from police and sabi pesin on wetin to do to improve your personal security.

Security tips you need sabi wey fit save you

Tip 1. No use car stickers wey tok wia you dey work, especially if na ogbonge job.

Tip 2. No post pictures of your pikin for dia school uniforms or badges, protect your pikin.

Tip 3. Wen you go party, no let di band totori you sotay you start to dey spray money, use envelope.

Tip 4. No be di pesin wey go try empty ATM machine, or POS wit large withdrawal. You no need 50k for wallet to feel like man.

Tip 5. Always delete bank transaction notification especially SMS… you fit memorize your bank balance. Tear your POS/ATM receipt troway.

Tip 6. No jog wey day don dark, you suppose get sense pass dat. If you fit, carry pesin wey you trust follow bodi.

Tip 7. Always lock your doors, even if na just to waka outside to off gen.

Tip 8. Never-never-never wear your ID outside your work place. No bodi need to know wia you dey work.

Tip 9. Dey accountable wit your parent or your spouse, make pesin know wia you dey at every point.

Tip 10. If you fit no dey send pikin alone on errand outside your house, dem be soft targets.

Tip 11. No dey form big oga for your street with plenti donation for estate meeting, try dey modest.

Tip 12. Wen you dey give, give modestly and for private, try dey tok “I no fit spare dat kain money now”.

Tip 13. No too stay for office afta closing time, you fit do dat deadline work later or for house sef.

Tip 14. Make safety di number one tin you dey tink for your decisions always.

Tip 15. Mind wetin you dey post for social media about yourself.

Tip 16. Avoid to enta kabu-kabu car and bus wey dey stop for road, try enta bus or taxi from dia park to reduce di risk of one chance.