Inside first week of 2024 - All di kidnapping, attacks by gunmen across Nigeria

Wia dis foto come from, AFP
Di new year, 2024, dey barely one week old, but inside dat seven days, gunmen don kill about 30 pipo and kidnap more dan 80 odas as insecurity kontinu to rise for several states across Nigeria.
Dis dey happen in spite of wetin President Bola Ahmed Tinubu tok for im new year message wia im bin promise beta security for di kontri
"We dey work hard to ensure say we all get peace of mind in our homes, places of work and on di roads," Tinubu bin tok on for im speech.
But e no reach 24 hours afta dat message, on January 2, 2024, about 24 Nigerians lose dia lives sake of gunmen attack in Kaduna and Nasarawa states, as well as di Federal Capital Territory.
Di first na wen gunmen attack Dawaki Ward wey dey for Kauru Local goment Area of Kaduna State, kill 17 pipo and kidnap 58 odas. Residents tok say di attack wey happen for early hours of January 2, last for more dan six hours.
On di same day, gunmen attack one supermarket for One-Man Village, close to Mararaba, Nasarawa state, and kill four pipo.
Also, bandits attack a family for Bwari Area of di FCT, kill one person and kidnap 7 pipo. According to local media Daily Trust, two out of di three policemen policemen wey get gun injuries for di attack later die.
On Friday, 5 January anoda 12 pipo die for gunmen attack; six in Yobe State, inculidng a Christian pastor and him church members, and six traders wey run into bandits for Danmusa LGA of Katsina State, according to Punch Newspapers.
End of Di one wey oda users dey read well well
10 pipo kidnapped for Dutse

On Sunday, 7 January, gunmen wey wear military camouflage attack one Estate wey dey inside Sagwari area of Dutse, in Bwari Area Council of di FCT, and kidnap pipo wey dia number reach 10.
Di victims include a mother and her ffour children and two staff of a guest house wey dey inside di estate.
A staff of di estate wey no wan mention him name tell BBC say di attack happun around 7.30 for evening and di attack dey very fast, e no even reach 30 minutes.
Wen BBC visit di estate, we see police patrol vehicles as e dey go round, but residents tok say na becos of di attack na im make police show face.
"Before, na only di estate vigilante dey provide security for here, and dem no dey carry gun, na only big sticks and matchet dem get," di guest house staff tok.
Di FCT police command never tok anything about di attack. Josephine Adeh wey be police tok-tok pesin for FCT no answer her call, and no return text messages we send to her.
'Na God hand we dey' - Bwari Residents

Wia dis foto come from, Getty Images
Bwari area council of di FCT wia violent attacks don dey reported since January 1, na area wey get boundary wit Kaduna and Niger States. Insecurity don dey on di rise for di area for some time now, and some residents tell BBC say dey run comot for dia sake of fear for dia lives.
Popular residential areas dia include Dutse, Ushafa, and Bwari town - one community wey dey host di Nigeria Law School Abuja, and Veritas University.
"My family and I gatz comot for dia as e be say everyday na so so shooting we dey hear, and fear no dey gree us sleep," one resident tell tori pesin.
"My family don stay Bwari for many years, we neva see di kain of violent attacks wey don dey happen dia recently. Na im make we pack comot go dey squat for a friend house for di meantime," di pesin add.
Anoda pesin wey tok to BBC on condition of anonymity say kidnapping "na normal tin for dis our (Bwari) area...na only in God hands we dey safe".
A staff of Veritas University also narrate to BBC how some gunmen kidnap four pipo from im area during di holiday period, and afta dem rally round to raise di ransome, di kidnappers no gree release di pipo.
"Dem even hold di person wey go deliver di ransome, all five of dem still dey kidnappers hand reach now," e tok.
President Tinubu bin get meeting wit security chiefs and heads of intelligence agencies, wia e give dem marching orders to improve security.
“All malign actors go dey aggressively uprooted from our midst. Those wey dey work against di national agenda from within and without go meet justice," Tinubu bin tok for di meeting, according to a statement by presidential spokesperson, Ajuri Ngelale.
We dey redouble our efforts - Police

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Josephine Adeh wey be police tok tok person for FCT tell BBC say di police no go stop for dia efforts to make sure say di FCT dey safe for all residents.















