Tinubu suspend minister, drama for Aso rock, EFCC invitation - Wetin don happun so far for Betta Edu mata

President Bola Tinubu and di suspended Minister Betta Edu

Wia dis foto come from, Presidency

Di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu don attract negative attention just six months afta her appointment.

Edu, wey be 36 years old become di first minister under president Bola Tinubu to come under public condemnation for crime wey authorities and court neva confam say she commit.

One document show say for late December di minister instruct di Account General of di federation to pay money into one private account.

Leaked documents wey BBC Pidgin no fit verify show di mandate wey Dr Edu allegedly sign.

President Bola Tinubu on Monday order di immediate suspension of Dr Betta Edu from office.

Di suspension dey inside statement wey Special Adviser to di President on Media and Publicity, Ajuri Ngelale sign on Monday.

Dis na sake of di ongoing tok-tok of corruption allegations wey surround di minister Betta Edu.

Ngelale say e dey line wit im commitment to uphold di highest standards of integrity, transparency, and accountability in di management of di commonwealth of Nigerians.

Di President further direct di Executive Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) make dem conduct serious investigation into all aspects of di financial transactions wey involve di federal ministry of humanitarian affairs and poverty alleviation, and one or more agencies under am.

Shortly afta di suspension, one video show how Betta Edu dey comot from Aso Rock.

Tori be say she go di State House to see di president but e no clear weda she eventually get access to president Tinubu.

In di meantime, anti-corruption agency di Economic and Financial Crimes Commission don invite di minister.

Also, former Minister of Humanitarian Affairs, Sadiya Umar-Farouk bin Post for social media say she dey go honor EFCC invitation to ansa kwesion about di allegation wey surround di humanitarian money mata.

Nigeria goment bin don tok say dem go begin torchlight di tori wey dey fly upandan about payments wey di Ministry of Humanitarian Affairs make.

Local media report say she give instruction for di payment inside one letter wey showface for public and di date dem write di letter na December 20, 2023.

According to local media di letter wey dem title di “Mandate for Payment of Grant for Vulnerable Groups in Akwa Ibom, Cross River, Lagos and Ogun States Respectively”, di minister give directive to di Accountant-General of di Federation to transfer di money to one UBA account of one Oniyelu Bridget Mojisola.

As reactions loud for di mata, President Bola Tinubu give order say make dem do comprehensive investigation to dey sure if true-true dat kain tin happun.

Inside statement, Nigeria Minister of Information and National Orientation Mohammed Idris, tok about di tori wey dey spread evriwia say di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation allegedly use public funds.

"We acknowledge di concerns wey di public dey raise regarding di alleged payment of funds into one private account by di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation. We dey aware of di narratives wey don circulate well-well and wish to assure Nigerians say di goment take dis issues most seriously."

Betta Edu

Wia dis foto come from, Betta Edu X

Wetin we call dis foto, Nigeria Minister for Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu

Wetin dey cause dis gbas gbos?

Na for December, 2023 tori begin fly upandan for social media say di Minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu allegedly divert money to one private account.

Local media report say di she give instruction for di payment inside one letter wey show face for public and di date dem write di letter na December 20, 2023.

According to local media, di letter wey dem title di “Mandate for Payment of Grant for Vulnerable Groups in Akwa Ibom, Cross River, Lagos and Ogun States Respectively”, di minister give directive to di Accountant-General of di Federation to transfer di money to one UBA account of one Oniyelu Bridget Mojisola.

One document wey show face recently alleged say she pay N585,198,500.00 into di personal account.

Dis tori make Nigerians para well well.

'We no dey make payments on behalf of MDAs' - AGF

Meanwhile, di Office of di Accountant General of di Federation on 6 January, 2024 bin respond to wetin Betta Edu tok, wey say she direct di Accountant General of the Federation (AGF), Dr. Oluwatoyin Madein to pay grants to vulnerable groups for some states of di Federation.

For inside statement, di Accountant Generalof di Federation say, "OAGF no dey make payments on behalf of Ministries, Departments and Agencies(MDA's) for projects and programmes wey di MDA's dey implement.

"We dey release allocations to self-accounting MDAs in line wit di budget and such MDAs dey responsible for di implementation of dia projects and payments for such projects."

For di statement, di AGF explain say although dia office receive di request from di ministry, dem no carry out di payment.

"Di AGF note say for such situations, payments dey usually processed by di affected ministries as self-accounting entities and dem no suppose to make any bulk payment to an individual account in di name of project accountant.

Wetin Betta Edu don tok

Inside dis gbas gbos and controversies, di minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu say she no do anytin wrong.

She post for her X handle say pipo dey plan to tarnish her image and e go amount to nothing she emphasise on accountability and intergrity.

“Integrity and accountability na our watch word! Under my watch for di Ministry of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation no body go tiff goment fund as before.

“Di plans to tarnish di image of dis administration, my person or di ministry go amount to nothing,”

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

She also post for her facebook page wia she address di issue, according to her, she say, "di claims dey baseless and na an attempt to undermine di efforts we dey make to fight corruption and uplift di pipo wey dey in need..."

Betta Edu facebook

Wia dis foto come from, Screenshot

Betta Edu na Nigeria Minister of Humanitarian and Poverty Alleviation.

President Bola Tinubu appoint her as im become Nigeria president.

She take over from form Sadiya Umar Farouq wey EFCC dey investigate