Sadiya Umar Farouq deny "N2.67 billion school feeding fraud" ICPC trace to goment official private bank account

"Sadiya Umar Farouq" on "N2.67 billion school feeding"

Wia dis foto come from, Twitter/ Sadiya Farouq

Wetin we call dis foto, Sadiya Farouq
Read am in 2 mins

Nigeria Humanitarian Minister, Sadiya Farouq don distance herself and di ministry from di N2.67 billion school feeding moni wey di Independent Corrupt Practices accuse say dem divert to personal accounts.

Tori be say di Chairman of ICPC, Prof Bolaji Ownasoye Accuse goment officials say dem divert funds for school feeding to dia own account, according to Daily Trust report on Monday.

According to di report, Prof. Owasanoye, say di payment wey goment make to some federal colleges, one senior civil servant wey on die for di Ministry of Agric keep over N2.5 billion for imself and im colleagues.

"We observe say di transfers to sub-TSA na to prevent disbursement from being monitored. Nevertheless, we discover say payments to some federal colleges for school feeding in di sum of N2.67 billion during lockdown wen di children no dey for school, and some of di money end up for personal accounts. We don begin investigate di mata."

Since di report come out, di Federal Ministry of Humanitarian Affairs don dey under serious heat as pipo begin point accusing fingers to di ministry wey suppose dey supervise di distribution of palliatives for di kontri.

Di Ministry later put put tweet to say dia hand no dey for mago-mago wey ICPC discover say e happun for di school feeding programmes.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

"Sadiya Umar Farouq" on "N2.67 billion school feeding fraud ICPC reveal"

Wia dis foto come from, @NHGSFP

Wetin we call dis foto, Home gown school feeding programme

See wetin dem tok for di tweet.

Dem tok say pipo wey like cause trouble bin twist and misinterpret di statement by ICPC to direct am at di Ministry of Humanitarian Affairs.

Di Ministry also tok say di Federal Government Colleges school feeding wey ICPC dey tok about dey different from di Home Grown School Feeding wey dem dey in-charge .

Dem tok say Home Grown School Feeding na one of dia Social Investment Programmes and dis feeding programme no dey under any mago-mago investigation by di Independent Corrupt Practices and Oda Related offences.