N-Power: Batch A and B beneficiaries wey neva collect allowance get dia details for oda goment agencies

N-Power 2020 registration

Wia dis foto come from, NPower

Wetin we call dis foto, N-Power na job creation and empowerment programme of National Social Investment Programme of Nigeria goment. Di programme na to help young Nigerians.

Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development for Nigeria don tok say N-power beneficiaries wey neva collect dia allowance na sake of say dia name dey oda Federal agencies for di kontri.

Dis na according to statement wey Rhoda Ishaku Iliya, di Deputy Director for Information for di ministry sign on Thursday.

Di ministry say dem send di name of 516,600 N-Power beneficiaries to the Office of the Accountant-General of the Federation (OAGF), and 502,580 pipo don collect dia allowance through di GIFMIS platform wey goment recommend.

Dem add say di 14,020 wey remain na pipo wey be say dia money return sake of say dem get dia details for oda goment agencies, and "e dey against di law of N-Power programme".Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development for Nigeria don tok say N-power beneficiary wey neva collect dia allowance na sake of say dia name dey oda Federal agencies for di kontri.

Di Minister Sadiya Umar Farouq say im apologise for any inconvinence wey dis fit don cause pipo wey be genuine and eligible beneficiaries of di scheme.

He add say di OAGF go rectify di problem for genuine pipo wey don suffer sake of di screening.

Graduates wey dey under di first two batch of di N-Power programme bin don dey wonder wia goment wan put di 500,000 graduates wey don benefit from di programme as dem wan roll dem out to take in new pipo.

Some of dem enta social media to para say di goment still dey owe dem salary for March, April, May and June and dem wan make goment pay dem before e comot dem from di programme.