Bola Tinubu Ministerial list: Pate, Wike, El-Rufai, Umahi, Betta Edu and odas profile

Wia dis foto come from, Wike, El-Rufai, Umahi/Facebook
Former Rivers state Govnor Nyesom Wike, former Ebonyi state Govnor David Umahi, former Kaduna state Nasir El-Rufai and di All Progressives Congress, APC women leader Betta Edu na some of di pipo wey make Nigeria President Bola Tinubu ministerial list wey di Senate President Godswill Akpabio read out for di floor of di senate on Thursday.
In all, na 28 nominees di senate president read out for di list Tinubu present to dem on Thursday.
Nyesom Wike

Wia dis foto come from, RSGH
Nyesom Wike na two-term govnor of Rivers State from 2015 to 2023 and na for 12 December 1967 dem born am.
E also don be Executive Chairman of Obio Akpor Local Goment Area from 1999 to 2007.
For 2007, e bin be chief of staff to den Govnor Rotimi Amaechi of Rivers State.
For July 2011, Former President Goodluck Jonathan appoint am Minister of State for Education, later e come be Acting Minister of Education, but e resign before finishing im term to campaign for Govnor of Rivers State.
For March 2022, Wike declare say e go run for President of Nigeria under di People's Democratic Party ahead of di 2023 General election, but Atiku Abubakar win di primaries with 371 votes while Wike get 237 votes.
Nyesom Wike come from Rumuepirikom community for Obio-Akpor LGA and e attend Government Secondary School Eneka and Rivers State University of Science and Technology (RSUT) wia e obtain Bachelor of Laws degree from RSUT before e go Law School in 1997.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wike also hold a Master of Arts degree in Political and Administrative Studies from Rivers State University. E dey married to Justice Eberechi Suzette Nyesom-Wike and dem get three children.
Seven women make di list

Wia dis foto come from, Okotete, Musawa, Edu/ Facebook and Uzoka/LinkedIn
Nkiru Onyejeocha
Nkiru Onyejeocha come from Abia state, Southeast Nigera and dem her on November 23, 1969.
For 2002, she serve as commissioner of resource management and manpower development for Abia state bifor she win election as a member of house of representatives, representing Isuikwuato and Umunneochi federal constituency, Abia state for 2007.
Nkiru Onyejeocha don spend 12 years as a member of National Assembly of Nigeria, wey men dey dominate. She dey advocate say make president tell political parties make dem dey appoint certain percentage of women for elections.
For 2018, she join All Progressives Congress (APC) afta she commot for People Democratic Party (PDP).
Iman Suleiman Ibrahim
Iman Suleiman Ibrahim hail from Nasarawa state, North-Central, Nigeria.
Di former president Muhammadu Buhari bin appoint her as di director-general of National Agency for the Prohibition of Trafficking (NAPTIP) from December 2020 to May 2021 .
She complete secondary school for Federal Government Girls College, Bwari, Abuja . She study sociology for her first degree at University of Abuja, where she graduate at age 19.
For 2019, di govnor of Nassarawa, Abdullahi Sule appoint am as a member of the Nasarawa State economic advisory council.
She be di current honourable federal commissioner of the National Commission For Refugees Migrants and Internally Displaced Persons Office.
Dr Beta Edu Cross River

Wia dis foto come from, Betta Edu/Twitter
Dr Betta Chimaobim Edu born October 27, 1986, hail from Cross-River state, South-South, Nigeria.
Dr Betta Chimaobim Edu complete secondary school for 2001 for Federal Government Girls College, Calabar. She study medicine and surgery (MBBCh) for her first degree for di University of Calabar, Cross River State, South-South, Nigerian in 2009.
Betta Edu travel abroad go further her education wia she obtain three post graduates degrees from UK and U.S.A universities.
For 2013, Cross River State, ministry of health appoint as di medical officer of health. She be di youngest serving special adviser for di govnor of Cross River state, Benedict Ayade on community health from 2015-2016.
Di former govnr appoint am as di commissioner for health from December 3, 2019 to March 2022 before she resign go join party politics proper.
Dr Doris Uzoka Anite
Dr Doris Uzoka Anite hail from Oguta LGA, Imo state, South-East, Nigeria.
Di govnr of Imo state, Hope Uzodinma appoint am as di commissioner for finance and coordinating economy for 2021.
Stella Okotete
Stella Okotete hail from Delta state, South-South, Nigeria.
She graduate from Benson Idahosa University, Benin, Nigeria.
For 2017, former president Muhammadu Buhari appoint her as di executive director of business development for di Nigerian Export-Import Bank, she still dey her position.
Na she be di immediate past National Women Leader of All Progressives Congress (APC).
Uju Kennedy-Ohanenye
Uju Kennedy-Ohanenye hail from Akwa, Anambra state, South-East, Nigeria.
She dey among di presidential aspirant wey stepdown for president Bola Tinubu during di All Progressive Congress (APC), presidential campaign for June 2022.
Hannatu Musawa
Hannatu Musawa hail from Katsina state, North-West, Nigeria. She get degree in law from di University of Buckingham, UK.
For June 2023, president Bola Tinubu appoint am as di Special Adviser on Culture and Entertainment Economy.
Nasir El-Rufai
Nasiru Elrufai na di immediate past govnor of Kaduna state from 2015 reach 2023 .
Elrufai first win im gubernatorial primaries for 2014 under di All Progressives Congress (APC) and dem announce as di flagbearer for di party wia im defeat oda opponent for di 2015 govnorship election for Kaduna state. Elrufai don serve as two-time minister of ministry of commerce.

Wia dis foto come from, NASir El-Rufai/Facebook
Im bin serve as minister of federal capital territory (FCT) from July 2003 reach May 29, 2007 and don serve as director of di Bureau of Public Enterprises before.
Elrufai attend Barewa college wia im graduate for 1976 bifor im proceed go Ahmadu Bello University for Zaria, wia im receive first class bachelor degree for quantity surveying.
Im later go Ahmadu Bello University again for 1984 wia im receive Master of Business Administration.
Elrufai receive im law degree for di University of London for 2008, im study for masters degree in public administration for di John F. Kennedy School of Government of Harvard University in June 2009.
Prof Ali Pate
Ali Pate na health expert wey don serve as Nigeria former minister of state for health.
Na for Misau local government area for Bauchi State dem born Pate.
Im don serve as di global director for Health, Nutrition and Population, and Director of di Global Financing Facility for di World Bank, Washington DC.
Pate na Julio Frenk Professor of Public Health Leadership for di Harvard T. H. Chan School of Public Health and na im be di former CEO for Big Win Philanthropy.
Di ogbonge professor attend Ahmadu Bello University (ABU) medical school for Kaduna state and im dey certified by the American Board as a MD in Internal Medicine and Infectious Diseases.
Professor Pate get im MBA for Health Sector Concentration from Duke University for USA and im don also study for di University College London wia im also collect Masters Degree in Health System Management from di London School of Hygiene and Tropical Medicine.
For 2008, Ali Pate bin dey head di National Primary Health Care Agency (NPHCDA), reach 2011. Na dat time im dey very strong for di fight against polio epidemic for Nigeria.
Na July 2013 im resign to become Professor for Duke University Global Health Institute for USA.
Na since im don be member of di Board of Directors of di American International Health Alliance; im dey part of Bill and Melinda Gates foundation, Global Fund to Fight AIDS, Tuberculosis and Malaria.
For February 2023, dem appoint professor Pate as di Chief Executive Officer (CEO) for GAVI, but im reject am sake of say im wan serve di kontri wey im bin dey come from.












