Meet Namibia first female vice president

Netumbo Nandi-Ndaitwah

Wia dis foto come from, Netumbo Nandi-Ndaitwah

Wetin we call dis foto, Namibia first female vice president

Namibia don get new president afta di former President Hage Geingob die.

Di new president na Nangolo Mbumba, wey be former vice president under di late president.

Former President Hage Geingob die early morning on Sunday wen im dey receive medical treatment for hospital for di capital, Windhoek.

Hours afta im die, di new President Nangolo Mbumba take oath of office.

President Nangolo Mbumba go serve until wen dem go do elections later dis year and im imply say im no go contest di next election for im acceptance speech.

"I no go dey around for di elections so make una no panic," na wetin im tok for di swearing in ceremony wey dem arrange sharp-sharp for di state house 15 hours afta di former president die.

Wen im dey pay tribute to im predecessor, im say, "our nation remain calm and stable sake of di leadership of President Geingob wey bin be di chief architect of di constitution".

"I take on dis heavy mantle and I know about di weight of responsibility.

Im add say im go continue wit di legacies of di late president, and im also announce who im go work wit as vice president.

"Fellow Namibians, as I assume di office of di president, afta due consultations, na my pleasure to announce di appointment of Netumbo Nandi-Ndaitwah as vice president of di Republic of Namibia, wit immediate effect.

Nangolo Mbumba

Wia dis foto come from, Namibia presidency

Wetin we call dis foto, Namibia president, Nangolo Mbumba wen e take oath of office

Namibia first female vice president

Meanwhile, Namibia also get dia first female vice president for di history of di kontri and na 72-year-old Netumbo Nandi-Ndaitwah wey break di jinx.

Namibia new President Nangolo Mbumba wey be vice-president to di late president, announce her as im new vice president afta im take oath of office.

Netumbo Nandi-Ndaitwah na woman politician wey don dey around since.

She also be di vice president of The South West Africa People's Organisation wey officially dey known as SWAPO Party of Namibia, SWAPO party.

Profile of di vice president of Namibia

According to Namibia Parliament website, dem born Netumbo Nandi-Ndaitwah on 29 October 1952 for Onamutai, Oshana Region.

She get Master of Arts degree in Diplomatic Studies.

She be politican wey don hold different political positions especially for dia political party.

She don serve seven terms for di National Assembly from 1995 to di current term wey suppose end for 2025.

She be one of di front runners ahead of di elections for September, 2024.

Some positions she don hold na Deputy Prime Minister and Minister of International Relations And Cooperation.

Deputy Minister of Foreign Affairs, Minster of Information and Broadcasting.

Minister Women & Child welfare, Minister of Environment and Tourism.

Minister of Foreign Affairs, Deputy Prime Minister and Minister of International Relations And Cooperation since 2015.

Nangolo Mbumba/Netumbo Nandi-Ndaitwah

Wia dis foto come from, Namibia Presidency/ Netumbo Nandi-Ndaitwah

Wetin we call dis foto, President, Nangolo Mbumba/Vice President, Netumbo Nandi-Ndaitwah

Profile of Namibia President Nangolo Mbumba

According to Namibia goment website, dem born Nangolo Mbumba on 15 August 1941 for Olukonda, Oshikoto.

Mbumba graduate from Southern Connecticut State University for di United States wit a Bachelor of Science degree in 1971.

Two years later for 1973, im graduate from di University of Connecticut wit Master of Science in biology.

President Nangolo Mbumba bin don head plenti Namibian Ministries.

Some of di ministries na Agriculture, Water and Rural Development between 1993-1996.

Im also lead di Ministry of Finance between 1996-2003.

Oga Nangolo also head di Information and Broadcasting between 2003-2005 and di Education Ministry between 2005–2010.

President Nangola also head Safety and Security between 2010 and 2012.

And for 2012, im become di Secretary-General of SWAPO wia im serve untill 2017.