Namibia shock Tunisia to win dia first Afcon match

Wia dis foto come from, Reuters
Namibia shock every bodi afta dem win Tunisia for dia 2023 Africa Cup of Nations group match on Tuesday eveming.
Dia goal come from Deon Hotto 88th-minute header to give dem victory
Di Brave Warriors – wey dey ranked 115th for di world neva win any of dia previous nine Afcon matches before – deserve dia win for Korhogo.
Earlier before di goal come, dia striker Peter Shalulile effort bin dey cleared off di line but Hotto attack Bethuel Muzeu cross.
2004 champions Tunisia dey 87 places above Namibia for Fifa standings.
Check out di highlights of di match.
Second half
90+8 mins- Game don end oh! referee don blow im whistle
90+7 mins- Lubeni Haukongo don return back to di game.
End of Di one wey oda users dey read well well
90+6 mins- Lubeni Haukongo need medical treatment afta im pick up injury.
90+5 mins- Sayfallah Ltaief low pass inside di box, dey blocked and cleared.
90+4 mins- VAR decision. NO GOAL!
90+4 mins- Di referee Omar Abdulkadir Artan dey use VAR to look di goal.
90+3 mins- Deon Hotto goal dey ruled out for offside!
90+2 mins- Elias Achouri dey replaced by Bassem Srarfi
90+1 mins- Di The linesman raise im flag sake of one of di players from Tunisia bin dey offside.
90 mins- 5 min. of added time.
89 mins- 0 - 1
Goal! Bethuel Muzeu swing di ball deep inside du box to find Deon Hotto wey dey unmarked, and im close-range header fly past di keeper inside di roof of di net. 0:1.
88 mins- Deon Hotto play du corner, but e fail to find any of im teammates.
88 mins- Aprocious Petrus react well inside di box, but im shot dey blocked.
87 mins- Namibia no use di corner kick well
86 mins- Bechir Ben Said save Deon Hotto free kick
83 mins- Anis Ben Slimane don comot and Sayfallah Ltaief don enta
81 mins- Deon Hotto set piece dey cleared. Peter Shalulile waste correct opportunity as im send di shot wide
81 mins- Anoda header for Youssef Msakni but e go wide of di left post.
80 mins- Tunisia get corner kick.
80 mins- Youssef Msakni head di ball towards di roof of di net. But im effort dey blocked by Lloyd Junior Kazapua,
78 mins- E be like Peter Shalulile handle di ball
77 mins- Goalkeeper block Namibia corner
77 mins- Riaan Hanamub lovely ball inside di penalty area but tdi defence manage to clear di ball.. Namibia get corner kick.
75 mins- Youssef Msakni play find pass to Anis Ben Slimane, but im no fit connect well
Youssef Msakni (Tunisia) clips a neat ball into the box in the direction of Anis Ben Slimane, but he can't get on the end of the pass.
73 mins- Substitution. Bethuel Muzeu don comot for Prins Tjiueza.
71 mins- Di referee blows im whistle and players dey refresh dem selves
71 mins- Elias Achouri dey offside, di linesman don raise im flag.
71 mins- Absalom Limbondi pass dey blocked by Bechir Ben Said di move don break down.
A pass from Absalom Limbondi (Namibia) is intercepted by Bechir Ben Said and the move breaks down.
69 mins- Ali Maaloul play di the free kick.
69 mins- Free kick to Tunisia.
67 mins- Peter Shalulile miss one promising opportunity! Im jump to head di ball but na poor header.
66 mins- Ellyes Skhiri shot from just outside di box, but im attempt dey blocked by di defender.
65 mins- Deon Hotto dey alright im go fit kotinu
64 mins- Youssef Msakni get injury.
63 mins- Chance for Peter Shalulile for di middle of di box, im look up and shoot but di shot dey blocked by a defender.
63 mins- Lloyd Junior Kazapua read di game well to clear di danger afta Ali Maaloul try to connect wit di ball from just outside the box.
62 mins- Substitution. Ngero Katua don come in for Petrus Shitembi.
61 mins- Deon Hotto try to reach di ball but e dey too long and di ball don comot for field..
58 mins- Haythem Jouini dey offside.
57 mins- Elias Achouri cross di ball inside di penalty area. But defence clear di ball
56 mins- Free kick
55 mins- Haythem Jouini find space inside di box but im shot go wide
55 mins- Corner kick by Namibia but Tunisia defend well
51 mins- Namibia no profit from di corner as di defence clear the ball.
51 mins- Corner from Deon Hotto dey cleared by di defence. Namibia get anoda corner.
50 mins- Fine touch from Peter Shalulile im control di ball inside di box to shot to di bottom right corner, but di defence clear di ball
48 mins- Wajdi Kechrida don commit foul
47 mins- Ali Maaloul take di corner and sends di ball inside di penalty area, but di defence intercept di ball
46 mins- Montassar Talbi jump highest from corner to head at goal, but keeper save di ball
of the crossbar is brilliantly kept out by the goalkeeper. The ball goes out for a corner. Tunisia can continue in their attacking effor
46 mins- Second half don start
First Half

Wia dis foto come from, Getty Images
45+5 mins- Di referee don blows im whistle for half time.
45+4 mins- Peter Shalulile fire hot shot, but e go wide..
45+2 mins- Referee don blow im whistle afta Kennedy Amutenya rough tackle.
45+1 mins- Namibia free kick dey blocked by di defence
45 mins- 4 mins of added time
45 mins- Riaan Hanamub play di free kick inside di box, but di defence clear di ball.
44 mins- Dangerous play from Yassine Meriah (Tunisia). Referee don blows im whistle for a foul to Namibia..
44 mins- Elias Achouri no go fit kotinu to play.
42 mins- Tunisia get chance to score from corner kick, but di defender clear di ball.
41 mins- Elias Achouri need medical treatment, so di referee don stop play.
40 mins- Di defence dey alert to clear di dangerous cross from Elias Achouri. Tunisia get corner.
36 mins- Elias Achouri intercept Lloyd Junior Kazapua pass dat move don breaks down.
35 mins- Absalom Limbondi cross ball inside di area, but Bechir Ben Said intercept di ball.
31 mins- Riaan Hanamub play long-range free kick. But im effort no make sense.
31 mins- Yassine Meriah hold im opponent to prevent am from getting di ball and referee don blow for a foul. Na free kick near di sideline to Namibia.
26 mins- Referee don blow im whistle for cooling break sake of heat
26 mins- Tunisia fail to score from a corner as Lloyd Junior Kazapua jump to collect di ball.
25 mins- Deon Hotto go on a solo run, but im fail to create any chance wit di opportunity
24 mins- Flag don go up against Haythem Jouini for offside
23 mins- Ryan Nyambe don foul im opponent
22 mins- Deon Hotto break past challenges inside di box, but im pass too strong for Absalom Limbondi.
21 mins- Omar Abdulkadir Artan blow im whistle for a foul afta Prins Tjiueza foul im opponent
21 mins- Mohamed Ali Ben Romdhane play sweet pass inside di penalty area, but one of di defenders block am
20 mins- Di linesman raise im flag for offside before Peter Shalulile head di ball.
19 mins- Riaan Hanamub cross from the side inside di penalty area but nobody connect.
16 mins- Referee don blow whistle sake of Petrus Shitembi handball
16 mins- Referee don blow im whistle for free kick sake of Anis Ben Slimane rough challenge.
15 mins- Jalel Kadri dey forced to make a change. Taha Yassine Khenissi no go fit kotinu sake of injury, Haythem Jouini don enta.
12 mins- Taha Yassine Khenissi need medical attention.
12 mins- Ali Maaloul win di ball from di free kick, but im effort from di edge of di penalty area no dey accurate
11 mins-Tunisia get free kick.
10 mins- Wajdi Kechrida shot from diedge of the box, but di ball go ova di bar.
8 mins- Peter Shalulile get great chance afta fine cross find alone for box, but im shot weak.
7 mins- Elias Achouri bin dey too forceful wit im tackle but referee don blow for a free kick.
5 Mins- Taha Yassine Khenissi jump highest from di corner to head di at goal, but goalkeeper save di ball.
5 mins- Ellyes Skhiri cross di ball from corner inside di box box.
4 mins- Mohamed Ali Ben Romdhane dangerous cross dey blocked.
4 mins- Mohamed Ali Ben Romdhane pass di ball short to a teammate from corner instead of crossing di ball inside di box.
3 mins- Youssef Msakni pass di the ball from di edge of di box but di defender block am
1 mins - Referee don blow im whistle for Petrus Shitembi rough challenge.
I mins- Match don start
Tunisia lineup
Starting XI: Ben Said, Kechrida, Meriah, Talbi, Maaloul, Skhiri, Ben Romdhane, Ben Slimane, Achouri, Khenissi, Msakni
Subs: Laidouni, Haddadi, Ltaief, Srarfi, Valery, Sliti, Ghram, Hassen, Abdi, Rafia, Jouini
Namibia lineup
Starting XI: Kazapua, Nyambe, Amutenya, Haukongo, Tjiueza, Limbondi, Shitembi, Petrus, Hanamub, Shalulile, Hotto
Subs: Haoseb, Gebhardt, Hambira, Katua, Kambato, Muzeu, Kamatuka, Papama, Ndisiro, Wendell, Kamberipa, Maova














