Nigeria share point wit Equatorial Guinea for dia first Afcon 2023 game

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria share point wit Equatorial Guinea for dia first Afcon 2023 match.
Di game wey shelle on Sunday afternoon for di Alahassan Outtara stadium for Abidjan see di Super Eagles struggle to score goals despite say dem create more chances.
Di Super Eagles get 17 shots to Equatorial Guinea six. Dem also get six shots on target against di one wey dia opponent get.
Na di African Footballer of di Year Victor Osimhen lead dia attack – e score di equalizing goal afta Salvador bin open scoring for Equatorial Guinea.
Both goals come inside di first half.
Many pipo bin watch di second half wit plenty expectation say more goals go dey di match. But dat one no happun.
Di Napoli forward miss good chances including a one on one wit Owono wey prove im sef.
Di 22 year old Equatorial Guinea goalkeeper eventually become man of di match.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis one make am three straight times wey Nigeria neva win any game - Nigeria 1-1 Lesotho, Zimbabwe 1-1 Nigeria and Nigeria 1-1 Equatorial Guinea.
Di two teams dey Group A wit host Ivory Coast wey wey dey lead di group afta dia 2-1 win over Guinea Bissau.
Nigeria next match na against di host on Thursday.
Second Half
90mins+2: SUBSTITUTION! Paul Onuachu enta for Iwobi
90mins+1: SUBSTITUTION! Nlavo enta for Salvador
90mins: 6min added time
85mins: SUBSTITUTION! Jose Machin comot for Santiago Eneme
83mins: SUBSTITUTION! Bassey enta for Zaidu. Osayi-Samuel come in for Aina
80mins: Good from kick from Zaidu. Fine clearance by di Equatorial Guinea defence
76mins: MISSED CHANCE! Osimhen miss one-on-one. E no make sense
Nigeria 1-1 Equatorial Guinea
74mins: SUBSTITUTION! Pablo Ganet comot for Alex Balboa. Charles Ondo enta for Jannick Buyla
70mins: SUBSTITUTION! Simon Chukwueze enta for Moses Simon. Joe Aribo enta for Alhassan Yusuf
67mins: GOOD SAVE! Anoda sharp save from Owono from Ola Aina shot
65mins: YELLOW CARD for Zaidu Sanusi for time-wasting
58mins: Equatorial Guinea don find dia confidence again. Alhassan Yusuf no dey gree for dat defence
54mins: GOAL OPPORTUNITY! Zaidu don miss two golden chances. E make am two now but e no hit di ball well. Be like e dey lack confidence to score
51mins: Free chance for Aina to shoot. He make am easy for Owono to save
48mins: Good block by Troost-Ekong from Nsue run wey don dey worry di defence since.
Nigeria 1-1 Equatorial Guinea
45mins: Second Half don start

Wia dis foto come from, Getty Images
HALF TIME: Nigeria 1-1 Equatorial Guinea
45mins: MISSED GOAL! Nigeria for don dey lead from dat fine shot from Simon Moses wey hit bar.
Nigeria 1-1 Equatorial Guinea
38mins: GOAL! Nigeria sharply respon wit a soft touch by Victor Osimehn
Nigeria 0-1 Equatorial Guinea
36mins: GOAL! Salvado open scoring for Equatorial Guinea.
34mins: Both teams dey tackle dem sef well. Nobody don create any special moment
29mins: MISSED CHANCE! Di Napoli striker don miss two good chances so far.
26mins: YELLOW CARD. Bikoro chop card for foul on Nigeria player
24mins: Good shooting effort by Machin. Di bass in between di crowd go wide.
21mins: OFFSIDE! Anoda offside for Osimhen
19mins: Bikoro try test Nwabali wit a shot from outside di 18 yard box. Easy catch for di Nigerian keeper
15mins: Nsue dey really worry di Super Eagles
12mins: Yusuf just boot ball go uo from free kick wey Zaidu take.
9mins: MISSED CHANCE: Zaidu miss wonderful chance for early lead.
7mins: OFFSIDE! Nigeria for get dia first corner but Linesman catch Osimhen for offside.
5mins: Easy save for Nwabali from Akapo cross.
3mins: Iwobi dey move around and e try find Osimhen but Equatorial Guinea keeper dey alert
Nigeria 0-0 Equatorial Guinea
1min: KICK OFF
First Half

Wia dis foto come from, MINISTRY OF SPORTS/ FACEBOOK
Nigeria vs Equatorial Guinea line-ups
Nigeria: Nwabali, Aina, Ekong, Ajayi, Zaidu, Onyeka, Yusuf, Iwobi, Lookman, Moses, Osimhen
Equatorial Guinea: Owono, Akapo, Orozco, Coco, Ndong, Ganet, Bikoro, Buyka, Machin, Slavado, Nsue
Equatorial Guinea

Wia dis foto come from, Getty Images
For Equatorial Guinea, dis go be dia fourth Caf Africa Cup of Nations appearance, but dis na only di second time dem go qualify as non hosting kontri.
Dem dey always reach di knockout stages; quarter-finalists for 2012 and 2021, while dem carry 4th place for 2015 competition.
Equatorial Guinea neva score more dan two goals for dia former 15 matches for di CAF Africa Cup of Nations. Na only two of Equatorial Guinea 11 goals for Afcon na im dem don score for di first half of matches.
If dem repeat dia historical feat and secure a spot for di knockout round, e fit dey spell trouble for pre-tournament favourites like Nigeria or Cote d’Ivoire.
Equatorial Guinea ability to navigate difficult groups for 2012, 2015 and 2021, wey make dem beat di likes of Zambia, Gabon, and Algeria, don showcase dia resilience to upset di favourite teams.
Dis competition promise to deliver goals and celebrations, as both teams dey eager to secure all three (3) points.
Sunday games: Africa Cup of Nations fixtures
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Group A: Nigeria vs Equatorial Guinea – Alassane Ouattara Stadium, Abidjan by 3pm (WAT).
Group B: Egypt vs Mozambique – Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan by 6pm (WAT).
Group B: Ghana vs Cape Verde – Felix Houphouet-Boigny Stadium, Abidjan by 9pm (WAT).
Dey refresh this page for live updates














