Jamie Foxx wunjure afta pesin stone am glass for mouth on im birthday dinner

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Rachel Hagan & Noor Nanji
- Read am in 4 mins
Hollywood actor Jamie Foxx birthday dinner no go well afta e involve for argument wey end for injury for am.
Di Hollywood star bin dey do im birthday for di Beverly Hills restaurant, but im representative say di celebration dey cut short sake of di public argument wey lead to why e need stitches.
According to di representative, Jamie Foxx bin dey celebrate im 57th birthday on Friday wia di kasala happun and dem gatz stitch im hand.
Dis dey come again, few days afta di Django Unchained and Ray star bin reveal wetin cause im hospital admission for April last year.
Wetin happun for di birthday dinner
According to informate wey im representative provide, na gbege bin happun wen pesin throw glass for Jamie Foxx mouth.
E say di pesin dey even siddon for anoda table wen e throw di glass but dem security pipo don dey handle di issues.
Jamie Foxx representative tell CBS News wey be BBC US partner say "pesin for anoda table throw a glass wey hit am for mouth" and dem gatz stitch di hand".
Meanwhile, dem add say di Hollywood actor don dey recova.
Also, officials from Beverly Hills Police Department confam say di police attend to Mr Chow, one high-end Chinese restaurant, afta reports of an assault and e dey wit deadly weapon.
Police find say e get a physical fight wey happun between two parties for di restaurant, and di reports of assault show say deadly weapon dey.
Although, dem no speak more on wetin cause di fight, but na from dia Jamie Foxx bin sustain injury.
Di representative tell CBS News Los Angeles say Foxx bin dey dat restaurant for a celebration.
Though, di police no really mention im name specifically.
Na around 10:10pm wen di gbege dey go on pipo bin call di police to intervene for di matter.
As at wen we dey file dis tori, e neva dey clear if police don make any arrest and dem neve provide any oda information about di matter.
Jamie Foxx na ogbonge actor wey win Oscar for best actor for playing musician Ray CCharlesfor di movie 'Ray' in 2005.
Dem also nominate am for best supporting actor di same year for im movie role for 'Collateral'.
Which sickness do Jamie Foxx for 2023
Days ago, di Hollywood star bin reveal say na one headache wey im get bin cause am to dey for hospital admission for April 2023.
E tok am during one Netflix special wia e tell di audience say e bin suffer "brain bleed wey bin lead to stroke".
E tok say e bin get one bad headache one day and den ask for aspirin but bifor e go fit take am, e bin "pass out (black out). I no remember 20 days".
Dat time, im daughter Corinne Foxx bin tok say e bin experience "medical complication" but di family no share details about im health issues.
For one emotional chat wit di audience for Jamie Foxx: What Had Happened Was..., wey dem record for Atlanta, di city where e bin dey work wen e fall ill, Foxx say medics bin first send am home afta dem give am cortisone injection.
Im sister den come ova to see am and feel say e no be imself so she take am inside her car to Piedmont Hospital.
Na den wey doctor tell am say e get brain bleed wey don lead to stroke, add say: "If I no go inside im head right now, we go lose am."
E tok say im sister bin pray di whole time during im operation outside di theatre.
Doctors bin no fit locate di origin of di brain bleed.
Foxx bin also tell di audience say "your life no dey flash bifor your face, e bin dey kind of peaceful, I bin see one tunnel, I bin no see di light."
E bin joke: "E bin dey hot for dat tunnel, I dey go di wrong place?"
Foxx tok say di doctor bin tell im family: "E fit dey able to make full recovery but e go be di worst year of im life."
Meanwhile, for dis new injury wey e sustain on im birthday dinner celebration, Jamie Foxx representative say e don dey recova.









