Details of wetin Chimamanda Adichie tell Euracare Hospital to provide within seven days afta her son death

Chimamanda Adichie

Wia dis foto come from, BBC/Tom Pilston

    • Author, Gift Andrew
  • Read am in 5 mins

Ogbonge author Chimamanda Adichie don send seven days demand notice to one private hospital for Lagos dey demand all medical records wey relate to dia pikin wey die for dia facility last week.

Adichie dey accuse Euracare Hospital of negligence wey lead to di death of her child Nkanu Nnamdi, di hospital don deny.

Dis dey come few days afta di renowned author confam di death of dia pikin wey die on January 7, 2026 for di facility. For personal account wey she give, she bin raise allegations say di hospital no take proper care of di pikin and no follow standard procedure for di way dem handle di pikin case.

Tori be say doctors bin refer di deceased from Atlantis hospital to Euracare for one procedure wey go prepare am for evacuation to foreign hospital wia specialist bin dey wait for am. but di pikin die during di procedure.

Documents of di demand notice wey BBC Pidgin sight list plenty grievances of di Chimamanda and her partner Esege and ask di hospital to act upon receiving di notice.

Kemi Pinheiro law firm wey be counsel to di family sign di notice and send am to di hospital dey accuse di hospital, dia anesthesiologist and oda medical personnel of breach di duty of care wey dem owe di deceased.

Dem accuse di hospital say dem do multiple lapses for dia pediatric anesthetic and procedural care.

Di document allege say during di procedure, di hospital transfer di child without supplemental oxygen, no adequate monitoring and no enough medical personnel.

Oda issues dem raise be say di hospital allegedly no get basic equipment to resuscitate patient and say dem no comply by di standard pediatric anesthetia, patient-transfer and safety protocol.

Dem place di hospital on notice to preserve all relevant evidence whether physical or electronic. Dem also ask for CCTV footage of di hospital wey show di movement from procedure rooms to di corridors, electronic monitoring data, pharmacy and drug inventory records, crash cart and emergency equipment logs.

Di lawyers warn say if dem destroy, alter or loose any evidence after dem don receive di notice, dem go treat am as suppression of evidence and obstruction of justice, say e go get legal consequences.

Dem demand from di hospital all certified copies of di medical records wey relate to dia pikin within seven days, say if dem no do as di document talk, dem go get no option dan to pursue all available legal, regulatory and judicial remedies against di hospital and all dia medical personnel wey dey involved in di matter including di Medical Director.

Wetin Euracare tok about di incident

Euracare Hospital don respond to di allegations wey Chimamanda Ngozi Adichie sama dem ova di death of her son.

For statement wey dem send to BBC, Euracare say some report about di incident dey inaccurate as dem sympathise wit di family.

Di hospital describe diasef as reputable centre for complex medical care, and say dem get internationally trained professionals.

"Di patient, wey bin dey critically ill, bin dey referred to our facility for specific diagnostic procedures after e receive treatment for a period of time at two paediatric centres.

"Upon arrival, our medical team immediately provide care in line wit established clinical protocols and internationally accepted medical standards, including di administration of sedation wia clinically indicated," di statement tok.

Euracare say in di course of Nkanu care, dem work collaboratively wit external medical teams as recommended by im family and ensure say all necessary clinical support bin dey provided.

"Despite dis concerted efforts, di patient sadly pass away less dan 24 hours afta e present for our facility."

Di hospital say dem don commence detailed investigation wey dey in line wit dia clinical governance standards and best practices.

Euracare say dem remain committed to engage transparently and responsibly wit all clinical and regulatory processes.

"We recognise say di family dey grieve irreplaceable loss and we go continue to support dem in any way wey go bring comfort during dis devastating period."

Lagos State govment start investigation

Meanwhile di Lagos State govment don order investigation into di circumstances wey surround di death of Nigerian writer Chimamanda Ngozi Adichie pikin.

Di Lagos State govment condole wit di family of di author and say govnor Babajide Sanwo-Olu don direct di Health Facility Monitoring and Accreditation Agency (HEFAMAA) to immediately commence thorough, independent, and transparent investigation into di circumstances wey surround di incident, "wit a view to unravel di immediate and remote causes of di death".

Special Adviser to di Govnor on Health, Dr Kemi Ogunyemi say in line wit dis directive, HEFAMAA don since commence investigation and don visit di facility involved as part of di ongoing inquiry. Di agency go conduct comprehensive review of all allegations and reports wey relate to di incident.

"Di investigation go examine di allegations raised, including compliance wit established clinical protocols, professional conduct, patient safety standards, and di roles and responsibilities of all parties wey dey involved.

Findings of di investigation go dey public as soon as di process dey concluded, for di interest of transparency and public accountability," di statement tok.