Man die days afta burning divorced wife over wardrobe fight

Wia dis foto come from, Getty Images
Di police don explain how one man bin set imsef and divorced wife on fire wit lighter despite say dem don go apart.
Na di Ondo State police give dis update wia dem explain say dis two pipo bin dey married bifor but dem later separate.
Di man set fire for di two of dem bodi afta e lure her to come visit am for im house.
According to di police, di man bin call di ex wife to come carry one wardrobe afta dem don alreadi seperate from each oda.
Afta di man invite di ex wife to come carry wardrobe, e lock di door to threaten say e wan kpai imsef.
E later lock di door on both of dem, to say both of dem go dia togeda but e no give reason.
"Mr A call Mrs A to come ova and carry a wardrobe, wen she get to di house, e start wit threats of killing imself but later lock di door say both of dem go die togeda."
Di police add say both of dem bin get issues wey make dem go apart.
"Mr A marry Mrs A, along di line dem get issues wey make dem stay apart. Mr A use fuel and lighter to set imself and Mrs A for fire," di police add.
According to di police, di man bin die from di effect of di fire wey e set to burn im and di ex wife.
Sadly, dem refer di wife to three hospitals within 48 hours wey be say dem dey reject am sake of di degree of di injury.
"Mr A die on di spot while Mrs A get major burns, in less dan 48 hours, Mrs A don go to di 3rd Hospital."
Ondo state police advise say make pipo dey check di kain partner wey dem go dey spend life with and make dem stay away from bad partners.
Although, di police no really tok who dis two couple be but di matter don lead to serious threat to life.
Similar case don happun for June 2024 for Warri, Delta state wia one partner pour acid for di bodi of im lover.
Blessing Chinedu wey 25 year old acid survivor still dey wonder why her partner attack her wit di deadly chemical.
Di BBC News Pidgin speak to Blessing for interview wia she tok say evri tin happun very fast and bifor you know am her face 'don damage'.
"Na pesin wey I love, di papa of my children na im do me dis tin," she tok.
Di young mama of two pikin say she dey reason many tins, "wetin happun dey really pain me but I no want make devil take over mind."
Blessing say she no think say she fit forgive her man wey do am dis tin.










