How soldier stab and kill trader for Ondo market

Di soldier stab di woman for stomach

Wia dis foto come from, Getty Images

Serious wahala happun for Akure, Ondo state South-west Nigeria wen one soldier bin chook one trader for market afta dem argue ova price of item.

Di market pipo no gree ova di weekend wen one officer of di Nigerian army bin stab dia colleague sake of di quarrel wey happun between dem bifor for market.

Di gbege bin happun for Oke-aro junction wey be one of di popular selling point for Arakale area of Akure.

Report say na sake of di price of carpet di soldier bin return to stab di victim.

Di situation wey happun bin vex plenti oda traders wey make dem block di major roads for di state capital as dem show pain ova di death of dia colleague.

E take di effort of police for Akure to clear di road to allow make vehicles fit pass.

Eyewitness tell local tori pipo TheHope say di soldier bin come wear mufti as im drop from bike and suddenly im bring out dagger to stab di woman.

Di eyewitness tok say di deceased bin dey try stop di soldier from beating anoda trader wey be nursing mother wen dem dey argue ontop price of carpet.

Na for stomach di soldier bin stab her and she no survive am as she fall for ground.

According to di eyewitness, di soldier bin promise to come back to fight di woman afta di argument.

Na wen di soldier see say di woman don fall for ground as im stab am dagger for stomach, im run comot for di scene.

According to di Police tok tok pesin for Ondo State SP Funmilayo Odunlami-Omisanya, she confam di incident and add say dem don inform di army about wetin happun.

She say di police dey ontop di mata and dem go fish out who di suspect be.

"Na true, we don notify di military authority ontop wetin happun," SP Odunlami tok.

Incident wia Nigerian Army officer allegedly beat police to death for Lagos

For August 2022, one Nigerian police officer bin die afta some officers of di Nigerian Army allegedly beat am and im colleagues for Lagos state.

Di second one dey fight for im life for hospital.

According to reports, di army men bin dey ride on dia coaster bus wen dem enta traffic jam for di Lagos-Badagary expressway, some of dem comot for dia bus, manage reach di junction wia police men dey control di traffic.

For dia, dem allegedly beat up di officers, cease dia riffles and carri two of dem away.

Reports say di sojas bin reach up to 30 and bin dey undergo training for one army facility for Lagos dat time.

Di two officers dem abduct later land for hospital wia dem collect treatment, however Inspector Orukpe Monday later die from injuries e collect during di beating.

Police tok-tok pesin for Lagos Benjamin Hundeyin bin tell BBC Pidgin say dem dey do tok tok wit di army to resolve di mata.

E say dem dey expect to get back dia officer, plus di arms and ammunition’s wey di army men seize.

Policebin confam say dem notify di family of di deceased officer and arrangements dey go on for im burial.

Nigeria army also confam say e get incident wey happun between dia men and police officers for Lagos wey result for loss of di life of one police officer.

For statement wey di acting tok-tok pesin for 81 Division Olaniyi Osoba bin sign, e say di incident dey regrettable and dem don begin investigation to confam wetin really happun.

E say any pesin dem find say im commit offense go face di law.

Nigeria army bin go do condolence visit to di Lagos state police command for Lagos.