Hurricane Beryl - Di deadly storm wey dey scata di Caribbean islands

Debris of houses on Union island afta Hurricane Beryl scata di area

Wia dis foto come from, Alizee Sailly

One deadly hurricane wey don dey tear enta di Caribbean don dey move fast towards Jamaica.

Hurricane Beryl now na category five storm, wey mean say di winds and storm e carry for body fit destroy anytin.

Di storm start on Monday for Carriacou, one island wey be part of Grenada.

So far, report tok say about six pipo don die sake of di storm for Grenada and St Vincent.

Hurricane Beryl hit land on Monday as category four hurricane, wit sustained winds of 150mph (240km/h).

US National Hurricane Center (NHC) say Carriacou take direct hit from Hurricane Beryl "extremely dangerous eyewall" - one ring of thunderstorms wey dey produce heavy rain and particularly strong winds.

Communications wit Carriacou and di nearby island of Petite Martinique neva still clear.

Di Prime Minister of Grenada, Dickon Mitchell say di true extent of di damage no fit dey known until officials go fit reach di islands.

Hurricane Beryl also scata St Vincent and di Grenadines, to di north-east of Grenada.

Dia Prime Minister, Ralph Gonsalves, tok say di storm kill least one pesin.

E tok say Storm Beryl don "cause serious destruction".

According to di prime minister, di situation on Union Island - one small island wit around 3,000 inhabitants – dey very serious.

"Di reports wey I don receive show say 90% of di houses don scata finish," e tok.

Oga Gonsalves also warn say " more fatalities still fit dey, we no dey sure yet".

Thousands of pipo still dey without light and many dey for temporary shelters for St Vincent and the Grenadines, Grenada and St Lucia.

Fotos on social media show houses wey dia roofs don blow comot and residents dey pick through rubble to save wetin remain for dia possessions.

Barbados, wey bin earlier issue hurricane warning as Storm Beryl approach, be like say dem no too experience major damage.

One government official tok say while di whole kontri "dodge a bullet", make pipo no let down dia guard as "gusts still dey come, di storm-force winds still dey come".

'90% of di houses for our Island don fall' - Residents tok

Foto of houses wey destroy for Union Island

Wia dis foto come from, Alizee Sailly

Katrina Coy, one woman wey Hurricane Beryl scata her peaceful home for Union Island say she dey shock by di extent of di devastation she see.

Almost every building on di island, wey dey St Vincent and di Grenadines, don destroy, she tok.

“Union Island dey for terrible state afta Beryl pass. di whole island dey nearly homeless,” Ms Coy tok inside one video message.

“Hardly you go see any building wey still dey stand. Houses don crumble, roads dey blocked, di electricity poles don fall for streets.”

One Fisherman and fishing guide Sebastien Sailly tok say, “Everything don lost. I no get anywhere to live right now,” e tok.

E be resident of Union since 1985, e bin live through Hurricane Ivan for 2004. But Hurricane Beryl, e tok say dey anoda level.

“E be like say na tornado pass here. E don erase ninety percent of di island.”

Pesin still fit hear di extent of di shock and fear for im voice.

“I bin dey try hide wit my wife and daughter and, to tell you di truth, I no believe say we go come out alive.”

Im cousin, Alizee, wey dey run one hotel wit her family, describe a horrific experience as Beryl pass ova dia town.

She say she gatz push furniture against di doors and windows to keep di wind out.

One organic farmer, beekeeper and fisherman, Sebastien say Hurricane Beryl destroy im two farms and im beehives completely.

Still, di community immediate need na shelter. Pipo don dey try to gada wood and plastic sheet to build some kain temporary accommodation for dia families.

“To see water and food go dey tough,” e add.

Jamaica, Mexico, Haiti, Dominican Republic and oda islands Hurricane Beryl go still touch

Map wey show Islands Hurricane Beryl dey affect

Di NHC don warn say Beryl dey expected to bring "life-threatening winds and storm surge to Jamaica later dis week", most likely on Wednesday afternoon local time.

Jamaican government bin don issue hurricane warning and don ask pipo wey dey live for low-lying and flood-prone areas to comot find shelter for anoda place.

Before e reach Jamaica, Hurricane Beryl fit also cause damage for Haiti and di Dominican Republic, wey share di island of Hispaniola.

Haiti.

Guy Vital-Herne from di charity World Vision tell BBC say "as of right now, Haiti no dey ready for di storm".

"In di past, we don see as rains dey make road flood, collapse bridges and affect logistics, e go dey very catastrophic for Haiti if Beryl touch am right now."

Wetin be hurricane?

View of North Atlantic as several tropical storms move across

Wia dis foto come from, Getty Images

Hurricanes na powerful storms wey dey develop for warm tropical ocean waters.

For oda parts of di world, dem dey known as cyclones or typhoons. Together, these storms dey referred to as "tropical cyclones".

Tropical cyclones dey characterised by very high wind speeds, heavy rainfall, and storm surges - short-term rises to sea-levels. Dis often dey cause widespread damage and flooding.

Hurricanes fit dey categorised by dia peak sustained wind speed.

Dem dey rate major hurricanes as category three and above, e mean say dem reach at least 111mph (178km/h).

How hurricanes dey form?

Graph wey show ingredients wey dey needed for hurricane

Hurricanes, typhoons and cyclones dey start as atmospheric disturbances - for example tropical wave, area of low pressure wia thunderstorms and clouds dey develop.

As warm, moist air dey rise from di ocean surface, winds for di storm cloud go begin spin.

Di process dey linked to how Earth rotation dey affect di winds for tropical regions just away from di equator.

For a hurricane to develop and keep spinning, di sea surface generally need to dey at least 27C to provide enough energy, and di winds gatz dey almost di same height.

If all these factors come together, intense hurricane fit form, although di exact causes of individual storms dey complex.