Wetin we know about Moscow attack ahead of Ukraine and Russia peace tok

Wia dis foto come from, GOVERNOR ANDREI VOROVYOV/REUTERS
At least one pesin don die and three don wound for one "massive" overnight drone attack for Moscow, di Russia capital, according to local officials.
Di attack dey come some hours bifor one meeting wey dem plan between US and Ukraine officials afta di gbas-gbos between President Trump and President Zelensky for White House.
Ministry of defence for Russia tok say dem destroy or stop 337 Ukraine drones wey attack dem for night for Moscow and oda nine regions wey dey for Russia.

Wia dis foto come from, Getty Images
For one post wey e put for social media, Regional Govnor Andrei Vorobyev share pictures wey show one of di damaged apartments and burnt cars for wetin look like car park for Moscow region.
E tok say 12 pipo – wey include three children – gatz dey evacuated from dia damaged flats afta di overnight strike.
Di govnor of Moscow region tok say one pesin don die and three odas don wound. Reports tok say di attack damage some apartment blocks and cause one big fire for car park.
Four Moscow airports bin dey closed for some time.
Moscow mayor tok say Russian air defence shoot down more dan 60 drones as dem dey near di capital.
Dis one be like di biggest drone attack wey Ukraine don launch for and around Moscow so far. E involve plenty drones, some of dem even target residential areas.
Ukraine never tok anytin about am.
Two pipo don die for overnight drone attack - Moscow govnor

Wia dis foto come from, Getty Images
One more pesin don die afta di overnight drone attack for Russia, according to Moscow regional govnor.
Andrei Vorobyev tok say one 50-year-old man don die for hospital, and two oda pipo still dey hospital wit serious injuries.
Russia launch overnight attacks for Ukraine - Ukrainian authorities
Ukraine sef dey under Russian attack overnight, na wetin regional authorities tok.
Di attack include: • For di southern port city of Odesa, one fuel tank, one residential house, and one warehouse wey full of children’s toys catch fire afta drone attack. • For di northern Sumy region, Russian drones, artillery, and glide bombs attack di area. One civilian wound, and five residential houses damage. • For di southern city of Kherson, one 40-year-old cyclist wound afta Russian drone attack dis morning. • For di eastern Donetsk region, one pesin die and four wound afta Russian attack for frontline towns of Pokrovsk and Kostyantynivka.
Overall, Russia use one Iskander ballistic missile and 126 drones take attack Ukraine overnight, na wetin Ukrainian air force tok.
Di air force tok say dem shoot down di missile and 79 drones, while another 35 drones no carry payload and no cause any damage.









