US launch new 'self-deportation' app for migrants wey wan japada

Bag wey dem write deportation

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Bernd Debusmann Jr
    • Role, BBC News, Washington
  • Read am in 3 mins

Di Trump administration don turn one mobile application app wey dem originally create to facilitate asylum appointment – into app wey undocumented migrants for America fit take "self-deport" themselves.

Di app, wey dem call CBP Home, go allow migrants submit one "intent to depart", wey US Customs and Border Patrol tok say give dem chance to leave di kontri without "harsher consequences".

US officials don repeatedly suggest say make undocumented migrants for di kontri leave voluntarily, instead of make dem arrest dem and subject dem to deportation.

Dis na di latest move for di White House effort to dramatically change di US immigration system, wey bin include promise of mass detentions.

Wetin to know about di mobile app

Di US goment originally launch di app as CBP One for 2020, di Biden administration later expand di mobile application to allow prospective migrants to book appointments to appear for one port of entry.

At di time, officials dey use di application to help reduce detentions for di border and dem see di technology as part of effort to protect asylum seekers wey dey make di often dangerous journey.

Now, on to di newly rebranded application, undocumented migrants go identify themselves and declare dia intention to comot di kontri.

For one statement wey Fox News quote, Homeland Security Secretary Kristi Noem tok say by self-deporting through di app, migrants "fit still get di opportunity to return legally for di future and live di American dream".

"If dem no self deport themselves, we go find dem, we go deport dem, and dem no go ever fit return," she add.

Di app dey also ask migrants weda dem get "enough money to depart di United States" and weda dem get "valid, unexpired passport from dia original kontri of citizenship".

BBC don contact DHS for further details about how di process dey works once dem fill out di forms on di app.

Dem also fit use CBP Home apply and pay for I-94 entry and exit cards for up to seven days bifor travel, book inspections for perishable cargo and check wait times for US border crossings.

Di Trump administration bin move fast to scrap di CBP One app as part of one larger shift in immigration strategy. Dem also pause parole programmes, and uptick in Immigrations and Customs Enforcement (ICE) raids for di kontri follow.

For late February, di administration say dem go create one national registry for undocumented migrants and those wey fail to sign up, fit possibly face criminal prosecution.

Di registration require any undocumented migrants above di age of 14 to provide dia US government address and dia fingerprints.

Experts tok say dat registration system fit face problems, as e dey difficult to enforce and e get plenty logistic wahala.