Oil tanker and cargo vessel collide for North sea
One oil tanker and cargo vessel don jam for di North Sea as lifeboats and firefighting teams dey on di scene.
Reports say di ships collide off di coast of East Yorkshire and coastguard rescue operation dey currently go on.
Dem immediately call for a coastguard rescue helicopter from Humberside wit lifeboats from Skegness, Bridlington, Mablethorpe and Cleethorpes.
Two separate sources wey sabi about di crash tell di BBC say di oil tanker wey dey involve for di collision dey on fire.
Dem don send vessels wey get di power to fight firefighting to di scene of di incident.
Reports say dem don bring about 32 pipo come shore.
All crew ontop di tanker Stena Immaculate dey safe and accounted for, na so di shipping company tell BBC
More dan 20 pipo bin dey onboard di tanker - we no know di condition of di odas wey dem bring come shore.
Which tanker dey involved?
BBC business reporter Jonathan Josephs report say di oil tanker wey dey involved for di collision na MV Stena Immaculate wey dey go from Agio Theodoroi for Greece to Killingholme for di UK.
Reports say di US-flagged Stena Immaculate dey hit while e bin anchor, by di Portuguese-flagged container Solong, according to tracking data analysed by BBC Verify.
The Stena Immaculate na one of 10 vessels wey di US military dey use take carry fuel during conflicts or emergencies; e no dey clear how dem bin dey use am as at di time of di crash.
Di Stena Immaculate dey managed by US logistics firm Crowley and na Sweden Stena Sphere wey dey controlled by di billionaire Olsson family get am.

Oil tanker dey carry jet fuel wen dem hit am
US logistics firm Crowley wey be di operator and joint owner of di MV Stena Immaculate say di vessel dey carry jet fuel wen di Solong hit am for North Sea at approximately 10:00 GMT.
All of di crew of more dan 20 now dey safe and accounted for - but fear dey say jet fuel dey pour into di sea.
For statement, di Florida-based company say: "fire happun as a result of di allision, and fuel dey released. Di Stena Immaculate crew abandon di vessel following di multiple explosions wey happun onboard. All Crowley mariners dey safe and fully accounted for."
According to US official, one of di ships wey dey involve for di collision, di MV Stena Immaculate oil tanker, bin dey carry cargo for di US Department of Defense.
"Di collision and explosions no go impact operations or combat readiness. We no get a single point of failure," di officials say.
Di Lifeboat Institution add say reports from both vessels show say dem dey on fire as search and rescue teams from across di region don dey respond to di incident.
Statement from HM Coastguard say dem dey coordinate emergency response for di tanker and cargo vessel wey collide afta dem raise alarm for early morning.
"We call coastguard rescue helicopter from Humberside, togeda wit lifeboats from Skegness, Bridlington, Maplethorpe [sic] and Cleethorpes, HM Coastguard fixed-wing aircraft, and nearby vessels wey get firefighting capability.
Wetin trackers tell us?
Details about how di collision take happun still dey unclear, but with online tracking tools, BBC Joshua Cheetham still build a picture of wetin happun bifor di collision.
According to ship tracking site MarineTraffic, di Stena Immaculate bin travel from di Greek port of Agioi Theodoroi, and bin dey anchored outside Hull.
Di Solong bin sail from di Scottish port of Grangemouth to Rotterdam for Netherlands.
E show say di collision fit don happun for around 9:48 GMT.









