Trump announce new immigration pathway for South Africa farmers

Wia dis foto come from, Getty Images
President Donald Trump don offer to give South Africa farmers wey wan japa comot for di kontri, one very fast pathway to become America citizens.
Di US president wey give di informate on im own social media platform, Truth Social, on Friday add say di US go stop all di federal funding wey dey go South Africa.
Dis dey come afta e repeat im accuse against di South Africa goment say dem dey "seize" lands from White farmers.
"To go a step further, any Farmer (wit family!) from South Africa, wey wan run comot from dat kontri for reasons of safety, go dey invited into di United States of America wit one rapid pathway to Citizenship.
E say South Africa na "bad place to be right now," plus di process dem wan use bring di interested farmers go start immediately.
Oga Trump no provide additional details about di immediate plan.
In swift response to di US president post, di South African say dem no go follow oga Trump do "counterproductive megaphone diplomacy".
South Africa say dem still dey committed to building a mutually beneficial trade, political and diplomatic relationship wit Trump administration.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
One tok-tok pesin for South Africa tok say di relationship between both kontris suppose dey based on mutual respect.
For February Oga Trump bin issue one executive order, wey stop all aid to South Africa sake of wetin e allege as discrimination against di white Afrikaner minority, descendants of Dutch and French settlers.
Di American president tok say dem seize dia land without compensation, something wey South African goment deny. E also offer refugee status to Afrikaner farmers.
Afrikaners na one white predominantly Dutch ethnic group wey make up less dan seven percent of South Africa total population.
On Friday, Oga Trump say dem go give any farmer, no be just Afrikaner, any farmer wey wan relocate go di US, e add say dem go get rapid pathway to citizenship.
US goment bin cancel one American funding to HIV programs for South Africa last week.
Di goment bin also pull out of one climate agreement wey di aim na to get richer kontris to help one small group of developing ones, wey include South Africa, to move away from coal to green energy sources.
Wetin be di land mata wey Trump dey drag wit South Africa
For January, President of South Africa Cyril Ramaphosa bin sign one new law wey allow goment to seize pipo land witout compensation in certain circumstances.
Land ownership for South Africa na controversial issue bicos na di oyibo pipo for di kontri still get most of di farmlands, 30 years afta di end of di racist system of apartheid.
Pipo bin don dey call on goment to address land reform and deal wit di past injustice of racial segregation.
Oga Trump bin later write on im social media platform Truth Social: "I go cut off all future funding to South Africa until dem complete full investigation of dis situation!"
Later, wen e dey tok wit tori pipo, Trump say di South Africa goment "dey do some terrible tins, horrible tins".
"So dat one dey unda investigation right now. We go make a determination, and until we find out wetin South Africa dey do — dem dey take away land and dey confiscate land, and actually dem dey do tins wey dey perhaps far worse dan dat."
In response, South Africa Minister for International Relations, Ronald Lamola, also write for X say im bin hope say Trump advisers go use "dis investigative period to deepen dia understanding of South Africa policies as a constitutional democracy".
"Such insights go ensure a respectful and informed approach to our democratic commitments," oga Lamola tok.
Di South African president say di goment neva confiscate any land.
For inside one statement, Ramaphosa say di new law no be "confiscation instrument, but na constitutionally mandated legal process wey go ensure public access to land for equitable and just manner as guided by di constitution".
E add say South Africa no dey receive any oda funding from di US except for di US aid programme Pepfar, wey represent "17% of South Africa HIVAids programme".










