Court send man to death afta e burn wife sake of her skin colour

- Author, Geeta Pandey
- Role, BBC News, Delhi
- Read am in 4 mins
Dis article contain details wey fit turn some pipo belle.
One court for India don give death penalty to one man wey burn im wife alive sake of her skin colour.
For her statements bifor her death, Lakshmi tok say her husband Kishandas "routinely dey taunt her sake of say she get dark skin".
District Judge Rahul Choudhary for di northern city of Udaipur explain di death penalty as e say di murder bin fall for di category of "rarest of di rare" and na "crime against humanity".
Kishandas lawyer tell di BBC say im client dey innocent and say dem go appeal against di order.
Lakshmi murder eight years back and di judgement, wey dem deliver for weekend, don make headlines for kontri wia public obsession wit colourism dey well documented.
Di attack on Lakshmi bin take place on di night of 24 June 2017, according to di court order wey BBC see.
Di judgement quote from di statement wey she give bifor her death to di police, di doctors and one executive magistrate.
Lakshmi say her husband dey always call her "kali" or dark skinned and body-shame her since dem marry for 2016.
On the night wey she die, Kishandas bin bring one plastic bottle wit brown liquid - e say na medicine to make her skin fairer.
According to di statements, e bin apply di liquid to her body and wen she complain say di tin dey smell like acid, e set her on fire wit incense stick. Wen her body start to dey burn, e poured the rest of the liquid on her and ran away.
Kishandas parents and sister bin take her to hospital wia she later die.
"E no go be exaggeration to say dis heart-rending brutal crime no be just against Lakshmi, but na crime against humanity," Judge Choudhary tok for im order.
E say Kishandas "bin break her trust" and bin display "excessive cruelty as im pour di remaining liquid for her body" as she dey burn.
"Na crime wey shock di conscience of humanity wey pesin no go fit imagine for a healthy civilised society," di order add.
Public prosecutor Dinesh Paliwal bin describe di order as "historic" and tell di BBC say im hope say e go act as "lesson for odas for society".
"Dem bin brutally murder one young woman for her early 20s. She be pesin sister, pesin daughter and pipo bin dey wey bin love her. If we no save our daughters, who go save dem?" Im tok.
Mr Paliwal say im don forward di order to di high court to confam di death sentence, but e add say di conviction get 60 days to appeal.
Kishandas lawyer Surendra Kumar Menariya tell di BBC say Lakshimi death na accident and no evidence dey against im client wey di lawyer claim say dem falsely charge.
Di Udaipur court order don put spotlight on India unhealthy preference for fair skin once again.
Dem dey abuse and insult girls and women wey get dark skin tones and dem dey face discrimination; and skin lightening products na big business for dia wey dey earn billion dollars of profits.
For matrimonial columns, dem dey almost always emphasise on lighter-skinned brides wey dey more in demand.
For di past, BBC bin don report incidents of suicides by women wey dia husbands don abuse well-well sake of dia "dark complexion".
In recent years, campaigners don challenge di beliefs wey pipo get well-well say fair skin beta pass, but dem say e no easy to encounter deeply entrenched prejudices.
Until e change, dis attitude of discrimination go continue to ruin dia lives.










