President Mahama nominate Dumelo, odas as deputy ministers

Wia dis foto come from, Ghana Presidency
Ghanaian president John Mahama don nominate 13 pipo wey fit join im cabinet.
E release dis informate for press release wey dem share on Wednesday by di tok-tok pesin of President Mahama, Felix Ofosu Kwakye.
One of di nominees na politician and actor John Dumelo wey dey nominated for di role of Deputy Minister for food and Agriculture.
Di list only get two women wey dey nominated for appointment.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Di rest of di nominees include:
Thomas Nyarko Ampem - Finance ministry
Ebenezer Okletey Terlabi - Interior ministry
Ernest Brogya Gyenfi - Defense ministry
End of Di one wey oda users dey read well well
Clement Abas Apaak - Education ministry
Richard Gyan-Mensah - Energy and Greem Transition ministry
Alhassan Sayibu Suhuyini - Roads & Highways ministry
Justin Srem-Sai - Justice ministry & Attorney General
Yusif Sulemana - Lands & Natural Resources ministry
Rita Naa Odoley Sowah - Local goment, Chieftaincy and Religious Affairs ministry
Gizella Tettey-Agbotui - Works, Housing and Water Resources ministry
Yussif Issaka Jajah - Tourism, Culture and Creative Arts ministry
Samson Ahi - Trade, Agribusiness and Industry ministry
Dis nominations dey go di appointments committee of di Ghana parliament for vetting.
Di committee wey dey chaired by di First Deputy Speaker and di Minority leader as rainking members wey suppose hold public consultation and report dia recommendations give parliament within three days.
Dem dey make approval decision either by consensus or by vote.
Dis dey come almost one month afta di Ghana President bin nominate di ministers for im goment.
Dis na di biographies for di Deputy Minister nominees.
Thomas Nyarko Ampem - Finance ministry
Thomas Nyarko Ampem na Member of Parliament for Asuogyman constituency wey dey serve im second term dia.
Di 46 year old MP bin don hold down work as di District Chief Executive and Finance Director for di Inter-Ministerial Co-ordinating Committee on Decentralisation.
Ebenezer Okletey Terlabi - Interior ministry
61 year old Ebenezer Okletey Terlabi na member of parliament for Lower Manya Krobo constituency for im third term now.
Di Biochemist bin work as lecturer for di Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST) and as research officer for di Council for Scientific and Industrial Research (CSIR) for Ghana.
Clement Abas Apaak - Education ministry
Dr Clement Abas Apaak na MP for Builsa South constituency for two terms.
Im na PhD holder from Simon Fraser University bin work for both di Simon Fraser University and di University of Ghana. E bin also work as Presidential Staffer for di Office of di President.
Richard Gyan-Mensah - Energy and Green Transition ministry
42 year old Richard Gyan-Mensah na first time MP for Goma West constituency.
E don work for different positions wey include General manager for Desert Oil, Head of Finance and accounting for Petrosol Platinum Energy.
E also work as assistant accounts manager, Union Oil Ghana, accountant for Trust Hands Auto, part time teacher for City Business College, teacher for Gomoa Dominase D/A JSS, board member for both Gomoa Senior High Technical School and Petrosol MS and technical director for di Downstream Petroleum Institute.
Alhassan Sayibu Suhuyini - Roads & Highways ministry
Alhassan Sayibu Suhuyini na MP for di Tamale North Constituency.
Tori be say di 46 year old MP bin dey work as journalist bifor im shift to politics.
E dey currently run im PhD for di University of Ghana.
Justice Srem-Sai - Justice ministry & Attorney General
Justice Srem-Sai na lawyer for Praetorium Solicitors and also dey work as senior lecturer for di Faculty of Law for di Ghana Institute of Management and Public Administration (GIMPA).
Bifor e start ot dey work for dia, im LinkedIn place am for Havard Law School wia e work as teaching assistant and UBA wia e bin work as National Service Personnel.
Yusif Sulemana - Lands & Natural Resources ministry
Yusif Sulemana na two time Member of Parliament for Bole Bamboi constituency.
E work for Eximbank of Ghana as Project Manager and Unibank Ghana as relationship manager.
Rita Naa Odoley Sowah - Local goment, Chieftaincy and Religious Affairs ministry
Rita Naa Odoley Sowah na MP for di Dadekotopon constituency.
She don work as CEO for Flowers of Hope International and bifor she join parliament as MP, she bin work as di Office of member of parliament for her constituency and Municipal Chief Executive for La Dadekotopon.
Gizella Tettey-Agbotui - Works, Housing and Water Resources ministry
Gizella Tettey-Agbotui na architect wey dey serve for di 8th parliament of Ghana for di Awutu Senya West constituency.
She be di Chief Executive Officer for Zella Architects.
Yussif Issaka Jajah - Tourism, Culture and Creative Arts ministry
Yussif Issaka Jajah na MP for di Ayawaso North constituency for two terms now.
E don work as Senior research officer for di Inter Ministerial Coordinating Committee on Decentralization.
John Kofi Setor Dumelo - Food and Agriculture ministry
John Dumelo career as actor as im also dey popular as businessman and farmer.
E dey work now as MP for di Ayawaso West Wuogon constituency.
Samson Ahi - Trade, Agribusiness and Industry ministry
Samson Ahi na di longest serving MP for dis list as e dey serve im fifth term for di Bodi constituency.
Bifor dem e bin work as Minister of state for Ghana goment and sector manager for Amajaro Ghana.














