How Tems finally carry Grammy winning 'Love Me Jeje' enta global stage 28 years later

Seyi Sodimu and Tem

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

After her first solo win for di Grammys, Tems come on social media to thank veteran musician, Seyi Sodimu for im effort for di song wey win, Love Me Jeje.

Tems wey her mama name am Temilade Openiyi bin write for X wey dem dey call Twitter bifor say, "I just wan thank di ogbonge Seyi for im role for di support and clearinf of im OG song Love me jeje. E bring di oroginal song back to life and I dey glad say e don get im flowers today. Na timeless classic."

Seyi tok for interview say "di phone call wey I get from Tems pipo na for March, so na dis whole year don dey life changing". E tok dis one for IG Live wit broadcaster, Abass Tijani.

E explain say, in March e bin receive email for RC records wey go straight to spam, until im partners call am say Tems need am to sign off on di song and e take one week wit di help of lawyers to take care of di whole mata.

Na so oga Sodimu hala wen e hear say dem wan put am inside di music video sake of say e bin no know say e go even dey di video.

According to Oga Sodimu, "Tems tok say she bin wan make I dey di video so dat pipo go sabi di origin of di video".

E bin also tok say e nearly cry wen e hear di way she sample im song for her own version bicos of say im see di song as im own pikin wey don grow.

Dis dey come afta clip during di Grammys week for 2004 comot wey show a younger Seyi Sodimu dey tok how di song comot two years afta dem finish am.

E say, "I carry am go different record labels but dem tell me say I resemble American but I sound too African. As I carry am go Nigeria within two weeks, di song take off. Bifor I comot Nigeria, na di main song dem bin dey play for weddings."

As part of di wins wey di rebirth of Love Me Jeje cause, for May 2024, di Africa Magic Viewers' Choice Awards invite Oga Sodimu and Shaffy Bello to sing.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

For dat IG Live, e even explain di way e take meet actress, Shaffy bello wey feature for di original Love Me Jeje.

Tori be say di song bin comot for 1997 for im Born in Africa album. Oga Sodimu tok say di first song wey im record for di album wey dem dey call Ayo bin get part wey pesin suppose sing im name but nobodi fit sing im name correctly, na wen im broda babe at di time come introduce am to Shaffy Bello wey "bin dey amazing for di track and na so we take click".

Shaffy Bello bin also feature for anoda ogbonge hit of di 2000s from Seyi Sodimu wey dem dey call Mr Money Man.

Love Me Jeje na di first single wey comot off Tems first album wey she title BORN IN THE WILD.

She bin write di full song and na Spax and Guiltybeats follow produce am.

According RCA records, "dis song dey pay homage to Tems childhood and upbringing."

Sh bin announce say di song go comot for her first eva Coachella set even as na dia too she bin first perform am.

Who be Tems?

Tems wey be one of di fastest rising female music artist for Nigeria dey popular wit releasing hit singles.

Dem born Tems for July 23, 1996. She go secondary school for Lagos bifor she go South Africa for University education.

She reveal for interview say she start to dey go around different studios to dey learn how dem dey work from wen she dey di age of 18.

She don also reveal for interview say na she bin produce di sound for Try Me from wen she bin dey University.

Though most of her song don do well, na her collabo wit multiple award-winner Wizkid don further put her for limelight.

Di two Nigerian release "Essence" wey top di Billboard charts for 2021.

On August 31, 2021, di Nigerian singer become BET Amplified Artist of The Month of August 2021.

She go on to sing and co-write song for Rihanna for di Wakanda Forever Album wey get am Oscar Nomination.

For 2022, She follow Drake feature for one future song wey im call WAIT FOR U. Dat song bicom im first number one track for Billboards in two years.

She bin also feature for Canadian superstar Drake album wey im call Certified Lover Boy [CLB].

Who be Seyi Sodimu?

Seyi Sodimu na US-based Afrobeats musician wey don dey di industry for about 30 years.

E be di founder of Livewire productions wey don organize some ogbonge live shows wey don happun for di kontri like di 2023 Queens of Afrobeats concert and Kizz Daniel 2022 Live In Lagos Concert.

E also be di CEO of Goodlife Entertainment.

So far, e be like dis collabo on top sampling of Love Me Jeje don ginger singers of dis generation to follow am even though some of dis collabo happun bifor.

Fireboy bin collabo wit OdumoduBlvck, Boj, and Joeboy to sing new version of di Afrobeat RnB group Styl Plus song wey dem dey call Olufunmi.

Johnny Drille run di remix of Sound Sultan hit song Area for 2020 about a year bifor di legendary musician lose im battle to cancer.