Why Russia wan cause kasala on di streets of UK and who be dia target

MI5 Director General Ken McCallum dey give im speech. For im back na one blue MI5 branded backdrop. E dey wear glasses, wit a dark green tie and a suit.

Wia dis foto come from, PA Media

Read am in 4 mins

Di Head of M15 confam say Russia intelligence agency dey on a mission to cause "non-stop kasala for British and European streets".

Ken McCallum as e dey give im annual update on security threats wey UK dey face tok say, GRU agents bin carry out "arson, sabotage and more dangerous actions wey dem do wit increasing recklessness" for Britain afta di UK support Ukraine for dia war wit Russia.

MI5 bin also respond to 20 plots wey Iran support since 2022, e tok. E add say na Islamist extremism dey carry out most of dia work followed by extreme right-wing terrorism.

Di complex mix of terror-related threats and threats from nation states mean say MI5 bin get "one hell of a job for dia hands", e warn.

For di long speech, e tok say:

Di number of young pipo wey dey join online extremism dey increase, as 13% of those dem investigate for terrorism involvement dey under di age of 18.

E say dem don frustrate a total of 43 late-stage plots wey involve firearms and explosives to commit "mass murder" in the UK had been foiled since 2017.

Di number of state-threat investigations wey MI5 dey carry out don increase by 48%

Counter-terrorism work still dey between "75% Islamist extremism, 25% extreme right-wing terrorism"

“Different beliefs and ideologies" bin dey wey MI5 gatz deal wit, e tell tori pipo for di MI5 counter-terrorism operations centre for London.

"Di first 20 years of my career hia bin dey full of terrorist threats.

"We dey face those ones now alongside state-backed assassination and sabotage plots, against di backdrop of one major European land war," e tok.

Di UK "leading role" in supporting Ukraine means say "we loom large for di fevered imagination of Putin regime" and further acts of aggression on UK soil suppose dey expected, e warn.

Di UK current terror threat level dey substantial – wey mean say attack dey possible.

Dem don expel more dan 750 Russian diplomats from Europe since Russia invasion of Ukraine, "most of dem be" spies, oga McCallum tok.

Dis bin affect Russian intelligence services' capability, e explain, and add say dem deny diplomatic visas to those wey Britain and allies consider as Russian spies.

Russian state actors bin turn to proxies like private intelligence operatives and criminals, to do "dia dirty work", but dis bin affect di professionalism of dia operations and make dem easier to disrupt.

Although Oga McCallum bin don publicly tok before about both di Russian and Iranian threats, e neva open up Moscow plainly like dis bifor.

On Iran, e say di 20 Iran-backed plots wey MI5 bin respond to bin present "potentially lethal threats to British citizens and UK residents".

E say since di 2022 killing of Mahsa Amini - thdie 22-year-old wey die for Iranian police custody afta dem arrest her on top accuse say she allegedly violate rules wey require women to wear headscarf - "we don see plot afta plot here for di UK, at an unprecedented pace and scale".

E say na “lone individuals wey dey brainwashed online" dey make most of di threat.

Home Office figures dem publish last month show say di 242 pipo dem detain on suspicion of terror offences in di year to June, 17% (40) dey di age of 17 and under.

Sir Keir Starmer acknowledged the "sober findings" outlined by Mr McCallum but said the public should be "reassured that our security services are world class and will do everything necessary to keep us safe".