'My goment go serve you weda you vote Labour or not' - Highlights of Starmer first speech as UK PM

Wia dis foto come from, Getty Images
Di new Prime Minister of di United Kingdom Sir Keir Starmer don address di pipo of im kontri for di first time as dia leader.
For im speech for 10 Downing Street, Sir Starmer assure di pipo of UK say im goment go serve dem weda dem vote Labour or not.
"Weda you bin vote Labour or not - in fact especially if you no vote Labour - I say to you directly, my goment go serve you.
Di Prime Minister tok say im goment go show say politics fit be a force for good.
"We don change di Labour Party, return am to service - dat na how we go govern. Kontri first, party second," e tok.
Sir Starmer tank Rishi Sunak and say make anybody no underestimate di extra effort wey im predecessor put in place to be di first British Asian PM of UK.
Di new PM also recognises di "dedication and hard work" Sunak bring to im leadership.
Sir Starmer say for too long, a blind eye dey turned as "millions slide into greater insecurity".
End of Di one wey oda users dey read well well
E say pipo dey work hard and do di right tin, yet wen di "cameras stop rolling, dia lives dey ignored".
"I want to say very clearly to those people – not this time," he says.
Sir Starmer tok say "changing no be like flicking a switch" as e accept say di world "dey
E say e go take a while but add say work to change go begin immediately.
Sir Starmer promise to "rebuild" di kontri "infrastructure of opportunity... brick by brick".
Im speak of di need for schools and affordable homes - tins wey "working class families like mine fit build dia lives around".
Sir Starmer say if im ask pipo now weda dem believe Britain go dey beta for dia children, many go say no.
E say im goment go fight to persuade dem "until you believe again". Sir Starmer say im goment no go dey burdened by doctrine.
Oda tins Starmer tok for im first speech:
- "Now our kontri don vote decisively for change and return of politics to public service."
- "Wen di gap between di sacrifices made by pipo and di service dem dey receive from politicians grow dis big, e dey lead to a weariness in di heart of a nation, e dey drain di hope, di spirit, di belief in a beta future."
- "Dis wound, dis lack of trust fit only dey healed by actions not words. I know dat, but we fit make a start today wit a simple acknowledgement say public service na privilege and your goment gatz treat evri single pesin for di kontri wit respect."
- "If I dey honest, service na merely a precondition of hope and e dey surely clear to evri one say our kontri need a bigger reset, a rediscovery of who we be."

Wia dis foto come from, Reuters
Rishi Sunak accept defeat as Labour party sweep UK general election
Labour bin officially win di 2024 general election afta dem reach di required 326 seats.
UK next Prime Minister Sir Keir Starmer say "change go start now", e tok for London.
"E feel good, I gatz dey honest," e tell im crowd of supporters.
As e dey address supporters for central London, Sir Starmer add say "tank you truly - una don change our kontri".
E add say di task of Labour goment na "notin less dan renewing di ideas wey hold our kontri togeda".
"We gatz return politics to public service," e continue say im goment go "show say e fit be a force for good".
Millions of voters cast dia ballots for UK first July general election since 1945.
Polling stations wey dem set up inside buildings like local schools and community halls bin open between 07:00 and 22:00 BST on Thursday, 4 July.
Around 46 million voters bin dey eligible to elect 650 members of Parliament go di House of Commons.
Dem declare di results for each area, or constituency all through di night of Thursday, 4 July and into Friday morning.
Dis na di first time since December 2019 wey di whole kontri go get say on who go sit as Members of Parliament for di House of Commons and which party go form di next goment.
Sunak accept responsibility for historic Tory defeat

Wia dis foto come from, Getty Images
Rishi Sunak tok say im accept responsibility for di catastrophic defeat im party, Conservative Party face for di general election.
Sir Keir Starmer bin lead di Labour Party to ogbonge victory and e don take ova from Oga Sunak as di UK Prime Minister.
Oga Sunak tell dia supporters: "British pipo no try wit di decision dem take tonight, plenty tins dey to learn... and I take responsibility for di loss."
As e dey tok for central London, Sir Keir say "change go begin now", e add say e feel good, I gatz dey honest".
As dem don almost declare all di result, e dey show say na Labour go likely form di next goment, wit a majority of 166.
Former Prime Minister Liz Truss, wey her small time for office make Tory lose support from which dem no recover from, lost her South West Norfolk seat to Labour by 630 votes.
Ms Truss see her huge 32,988 majority overturned, and di Reform candidate come third wit 9,958 votes.
She dey among dozens of senior Tories wey don lose dia seats, including Defence Secretary Grant Shapps, Commons leader Penny Mordaunt, Justice Secretary Alex Chalk and former minister Sir Jacob-Rees Mogg.














