Sir Keir Starmer in, Rishi Sunak out - Who be UK new Prime Minister and wetin go happun next?

Wia dis foto come from, Reuters
Di Labour Party win one landslide victory for UK general election.
Di party sweep hundreds of seats across di kontri and end 14 years of Conservative rule.
Sir Keir Starmer go dey appointed as prime minister later on Friday. Dis go end di era wey don see five different Conservative leaders run di kontri.
Rishi Sunak, di outgoing PM, bin accept defeat around 04:40 for morning, and gree say Labour win, e also say im don call Sir Keir to congratulate am.
For im victory speech minutes later, di Labour leader promise "national renewal" and add say im go put di "kontri first, party second".
"We don earn di mandate to relight di fire," e tell Labour activists for one victory speech. “Our work na to renew di ideas wey hold dis kontri togeda.”
Di result don mark total turnaround for di fortune of di party.
For 2019, Labour bin suffer dia worst electoral defeat for almost a century wen veteran left-wing politician Jeremy Corbyn bin lead di party.
End of Di one wey oda users dey read well well
On di oda side, Robert Buckland, one former Conservative minister wey lose im seat, describe am as "electoral Armageddon" for di Tories.
E dey expected to be di party worst result in almost 200 years, and mata dey ground on di future direction of di party wey go start in di coming days.
Dem bin count and announce di results all night long and plenty more action still dey wey go happun. Here na wetin dey happun and wetin all of dem mean.
A huge Labour victory

Britain House of Commons get 650 MPs, or members of parliament.
Each of dia "seats" represent an individual constituency - or one area – or somewhere for di kontri.
So far Labour don win 410 seats, while di Conservatives fall to just 119 and centrist Liberal Democrats get 71. Reform UK, one successor to di Brexit Party, dey set to pick up four seats.
Di expected 170-seat majority for di House of Commons for Labour na big number but e still no reach di 179 wey di party win under Tony Blair for di 1997 election.
But for more perspective, di Conservatives' win for di 2019 election under Boris Johnson - seen as a very strong performance – see dem get a majority of 80 seats.
A reminder: If one party hold a majority, e mean say dem no go need rely on oda parties to pass laws. Di bigger di majority, di easier e go be.
Big names fall one by one (but some survive)

Wia dis foto come from, PA Media
As constituencies declare dia results live on television – all candidates bin line up next to each oda on stage - some major moments dey.
Di one wey dey notable na di defeat of Liz Truss. Di former prime minister bin serve for just 49 days in Number 10 before her party comot her. She narrowly lose to Labour for di constituency of South West Norfolk, wia she bin hold huge 24,180 majority before.
Jacob Rees-Mogg, di former Conservative business secretary and arch-Brexiteer, na one of di biggest names wey suffer defeat. E lose im East Somerset and Hanham seat to Labour.
E tell BBC say im no fit "blame anybody oda dan imself" for di loss but e take "small silver lining" from di fact say Conservatives go be "at least di official opposition".
Grant Shapps, di defence secretary, still dey shocked afta e lose im seat for southern England.
Leader of di House Penny Mordaunt, wey run against Rishi Sunak for di party leadership before e become prime minister, also lost her seat.
Jeremy Hunt, wey serve as chancellor - UK wey na di same as finance minister – still get im seat but im number reduce.
Richi Sunak also win im seat for Yorkshire wit a comfortable majority of around 12,000 - but e use im acceptance speech to admit and confirm say im party lost di election.
Labour also lost two big names of dia own. Jonathan Ashworth and Thangam Debbonaire, pipo bin expect say di two go dey part of Keir Starmer incoming cabinet.
A new PM within a day

Wia dis foto come from, PA Media
Things dey move pretty fast for British politics - na very little time dey between election result and di installation of di new prime minister.
Rishi Sunak go dey out of 10 Downing Street – di British equivalent of di White House - within 24 hours, and Sir Keir Starmer go dey installed immediately afterwards.
But process dey. Oga Sunak go offer im resignation give di King, and di King go formally invite Sir Keir to form di next government for one meeting wey normally go happun for Buckingham Palace.
E go den perform di traditional walk up Downing Street – wey many world media go carry - before e address di nation from di steps of Number 10.
Afta dat, e go dey expected to invite top Labour MPs to Downing Street and appoint dem to im new cabinet.
So Who be Keir Starmer? Profile of di new UK PM

Wia dis foto come from, PA Media
Age: 61
Education: Reigate Grammar School, University of Leeds, University of Oxford
Family: E dey married to NHS occupational therapist Victoria Alexander. One son, one daughter
Parliamentary constituency: Holborn and St Pancras since 2015
Who e be?
Di Labour leader most often dey describe himself as pesin wey come from "working class background".
Im papa na toolmaker and im mama bin work as a nurse. Im mother bin suffer from Still disease, one rare autoimmune condition wey later make her no fit tok or waka.
E attend Reigate Grammar School, wey become private school two years afta e join. Na local council pay im school fees until e turn 16.
Afta school, e become di first pesin for im family to go university, e study law for Leeds and later Oxford.
For 1987, e become barrister and e develop specialism in human rights law.
Im work carry am go di Caribbean and Africa, wia e bin defend prisoners wey dey face death penalty.
For di late 90s, e offer im services for free give di so-called McLibel activists wey McDonald pursue sake of say dem distribute leaflets wey question di fast food giant environmental claims.
For 2008, dem name am di Director of Public Prosecutions, di most senior criminal prosecutor for England and Wales.
How e take enta power?
For 2015, e become di MP for Holborn and St Pancras for north London.
E serve for di former Labour leader Jeremy Corbyn frontbench team as im shadow Brexit secretary, wia e tok say holding a second EU referendum na something dem suppose consider.
Afta di party heavy defeat for di 2019 general election, Sir Keir contest to be leader – e win for April 2020.
For im victory speech, e promise to lead Labour "into a new era wit confidence and hope".
Wetin be im key pledges?
Some of di policy pledges wey Labour don make so far include:
- Healthcare: Cut NHS waiting lists by providing 40,000 more appointments each week, wey dem go fund by tackling tax avoidance and closing tax ‘loopholes’
- Immigration: Launch one ‘border security command’ wey go stop pipo-wey dey smuggle gangs from arranging small boat crossings.
- Housing: Build 1.5m new homes by reforming planning laws and introduce one scheme wey go give first-time buyers "first dibs" for new housing developments
- Education: Employ 6,500 teachers, wey dem go pay by ending tax breaks for private schools.
Nigel Farage finally don become MP

Wia dis foto come from, Reuters
Dis election insurgent party na Reform UK, di right-wing successor to di Brexit Party and di UK Independence Party.
Nigel Farage, dia leader bin finally win one seat on im eighth attempt - but dia party initial projection of 13 seats end up for four. Dia own still beta pass wetin UKIP and di Brexit Party ever do, and Oga Farage dey celebration mood.
Di party share of di vote still dey for around about 14%.
Reform bin draw controversy during di campaign on top one offensive statements wey some of dia candidates and activists bin make.
Former Conservative party deputy chairman Lee Anderson go join Oga Farage for di House of Commons.
From dia new seat for parliament, di party fit wan cause trouble for di Conservatives and pick off more voters from di party remaining base.













