US don ready to present 30-day ceasefire deal give Russia ova war wit Ukraine

US Secretary of State Marco Rubio and US National Security Advisor Mike Waltz address a press conference.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Na US Secretary of State Marco Rubio announce am afta peace toks between di US and Ukraine for Saudi Arabia
    • Author, Maia Davies
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Ukraine don tok say dem ready to accept immediate 30-day ceasefire wit Russia wey di US process afta just one day wey US-Ukraine bin tok for Saudi Arabia.

US Secretary of State Marco Rubio tok say dem go present di offer give Russia and say "di ball dey dia court". Moscow neva tok come outside on top di mata yet.

Ukraine President Volodymyr Zelensky say na US hand e dey to try convince Russia to agree to di "positive" proposal.

Tuesday tok-tok for Jeddah na di first official meeting between di two kontris since di ogbonge gbas-gbos between Zelensky and US President Donald Trump for di Oval Office on 28 February.

For joint statement, di US say dem go immediately restart intelligence sharing and security assistance to Ukraie wey Washington bin stop afta di public kasala wey gas for di White House.

Di US-Ukraine statement tok say, "both delegations don gree to name dia negotiating terms and immediately start negotiations wey fit lead to enduring peace, wey go give Ukraine long-term security".

Rubio tok for press conference for Jeddah late on Tuesday say e hope Russia go accept di proposal.

He say Ukraine don "ready to stop shooting and start talking", and if Russia reject di offer "den we go unfortunately know wetin dey block peace for hia".

E say, "Today we don make offer wey di Ukrainians don accept, wey be to enta ceasefire and go to immediate negotiations."

"We go take dis offer now to di Russians and we dey hope say dem go say yes to peace. Di ball dey dia court," e add.

Trump special envoy, Steve Witkoff wey bin dey di Jeddah toks, suppose travel go Russia in di coming days, one source familiar wit di planning tell di BBC, although dis fit change quickly.

Dis offer of 30-day ceasefire pass wetin Zelensky bin propose wey be partial truce for di sky and for di sea.

Di Ukraine president thank Trump for "di constructiveness" of di tok-tok wey happun for Jeddah.

For video message, Zelensky say Russia gatz "show dia willingness to stop di war or continue di war".

E add say, "time don come for full truth".

Di Kremlin neva publicly respond but dem bin tok earlier on Tuesday say dem go issue statement afta Washington don tell dem wetin dem discuss during di tok-tok.

But influential Russian lawmaker Kostantin Kosachev say any potential agreements go dey "on our terms, no be American".

Kosachev wey be chairman of di Federation Council international affairs committee say, "real agreements dey still dey written... for di front", as im add say Russian troops still dey advance for Ukraine.

Russia launch full-scale invasion enta Ukraine for February 2022. Moscow dey currently control about 20% of Ukraine territory.

For White House, Trump tell reporters say e go follow Russian President Vladimir Putin tok, and "hopefully" e go gree to di proposal.

Trump say, "pipo tok say e take two to tango" as e add say dem go fit agree to di deal in di next few days.

"We get big meeting wit Russia tomorrow and some beta tok-tok go hopefully happun".

E add say e dey open to invite Zelensky come back Washington.

Russian Foreign Ministry tok-tok pesin Maria Zakharova tok say Russia neva riule out toks wit US reps in di next few day, according to Russia state-owned news agency Tass.

Tori pesin ask weda Trump and Zelensky relationship dey "back on track", Rubio ansa say im hope say na "peace" dey back on track.

E tok say, "dis no be Mean girls or episode for tv show. Today pipo go die for dis war, dem die yesterday and sadly unless ceasefire dey, dem go die tomorrow".

Dis US and Ukraine teams bin meet afta overnight drone attacks wey kill at least three pipo near Moscow, wey Russia show as proof say Ukraine no wan use diplomacy end di war.

Trump and Zelensky don gree to finalise "as soon as possible" one critical mineral deal, na wetin di joint statement tok.

Ukraine don offer to grant di US access to dia rare earth mineral reserves for US security guarantee but di White House kasala spoil show.

Rubio say di deal no be wetin dem tok on Tuesday but na wetin Ukraine and US treasuries negotiate.

Di US delegation for Jeddah bin also include US National Security Adviser Mike Waltz.

Di joint US-Ukraine statement tok say Kyiv don repeat say Europe suppose dey inside any peace process.

Di shift for America approach to di war wey don include locking Europe out of tok don cause plenti emergency meetings between European leaders for recent weeks.

Di EU Commissioner President Ursula von der Leyen say di bloc see wetin happun for Tuesday as "positive development".

On Friday, Trump bin issue rare threat of more sanctions against Moscow to take push for di deal. Russia already get plenti sanctions from US bicos of di war.

Trump say e dey reason di move sake of say "Russia dey absolutely pound Ukraine for di battlefield right now".

Meanwhile, di war still dey happun for ground on Tuesday.

Three men die for di Moscow region for wetin dem dey call di biggest drone attack for di Russian capital since di start of di full scale war for Ukraine.

Anoda 18 pipo wey include three pikin bin injure, na wetin health officials tell di Russian tori pipo.

Di Russian defence ministry say dem intercept 337 drones wey Ukraine send to Russia and dem shoot down 91 of dem ova di Moscow region.

Ukrainian officials dey report Russian drone attacks on di capital Kyiv and plenti oda regions.

Ukraine air force say dem bin also shoot down 79 of di 126 wey Russia launch as well as one Iskander-M ballistic missile.

E no clear as at now weda any death bin dey.