Why dem arrest and dey send Philippines ex-leader Rodrigo Duterte go ICC Hague?
- Author, Joel Guinto
- Role, BBC News
- Reporting from, Singapore
- Author, Jonathan Head
- Role, South East Asia correspondent
- Reporting from, Bangkok
- Read am in 4 mins
One plane wey carry di former president of the Philippines, Rodrigo Duterte, don leave di kontri capital Manila, hours afta International Criminal Court (ICC) issue warrant wey accuse am of crimes against humanity over im deadly "war on drugs".
Di 79-year-old land police custody shortly afta im arrive di capital international airport from Hong Kong on Tuesday morning.
Hours later, di current President Ferdinand Marcos Jr confam say Duterte dey on chartered jet wey dey go Di Hague in di Netherlands, wia ICC dey.
Duterte bin challenge im detention but im fail to prevent im extradition.
During im time for office, dem bin kill thousands of small-time drug dealers, users and odas without trial.
President Marcos say im predecessor go face charges relating to wetin im describe as Duterte "bloody war on drugs".
"Interpol ask for help and we ansa," President Marcos tell one press conference. "Dis na wetin di international community expect of us... as democratic kontri wey be part of di community of nations."
Duterte daughter Sara, wey escort am go di Hague, na vice president and political rival of Marcos. She say di arrest equal to persecution.
Rodrigo Duterte no apologise for im brutal anti-drugs crackdown, wey lead to killing of 6,000 suspects wen im bin be president from 2016 to 2022, and mayor of Davao city before dat.
Nevertheless, im bin question di basis for di warrant, asking: "Which crime I commit?" for one video wey anoda of im daughter Veronica Duterte post online on Tuesday.
"If I commit sin, prosecute me for Philippine courts, wit Filipino judges, and I go allow myself to go jail for my own kontri," im tok for anoda video.
In response to im arrest, dem launch one petition on im behalf for Supreme Court – asking dem make dem no comply wit di request.
According to one statement from di court tok tok pesin, di former president bin also call for declaration make di Philippines withdraw from ICC for 2019, "effectively terminate" im jurisdiction over di kontri and im pipo.
D ICC say e still get authority for di Philippines over alleged crimes wey dem commit before di kontri withdraw as member.
Some of Duterte supporters gada for di airport compound, wia dem bin carry di former president go after dem arrest am.
"I dey sad becos I bin no tink say e go reach point wia dem go arrest am. For me, im do a lot for our kontri and dis na wetin dem do to am," one supporter, Aikko Valdon, tell tori pipo Reuters news agency.
State media say more dan 370 police na im dem send go airport and to oda "key locations" to make sure say dem maintain peace.
While im supporters dey criticise di arrest, activists call am "historic moment" for di pipo wey perish for im drug war and dia families, di International Coalition for Human Rights for di Philippines (ICHRP) tok.
"Duterte arrest na di beginning of accountability for di mass killings wey define im brutal rule," ICHRP chairman Peter Murphy tok.
Di former leader bin dey Hong Kong to campaign for di upcoming 12 May mid-term elections, wia im plan to run again for mayor of Davao.

Wia dis foto come from, Getty Images
Duterte arrest mark di "beginning of new chapter for Philippine history", political scientist Richard Heydarian tok. "Dis na about rule of law and human rights."
Heydarian add say authorities arrest Duterte sharply for airport instead of letting di mata go normally through di local courts to "avoid political chaos".
Duterte and Marcos families bin form one ogbonge collabo for di last elections in 2022, wia against di elder Duterte wishes, im daughter Sara run as Marcos Jr vice-president instead of contesting as president.
Di relationship scata for public in recent months as di two families pursue separate political agendas.
Marcos initially refuse to co-operate wit ICC investigation, but as im relationship wit Duterte family scata, im change im mind, and later indicate say di Philippines go co-operate.
Di 'war on drugs'
Duterte bin serve as mayor of Davao, one metropolis for south of di kontri, for 22 years and im don make am one of di kontri safest from street crimes.
Im bin use di city peace-and-order reputation to cast imself as tough-talking anti-establishment politician to win di 2016 elections by landslide.
Im bin use im im tok ginger security forces to shoot and kill drug suspects.
More dan 6,000 suspects na im police plus unknown gunmen gun down during di campaign, but rights groups say di number fit dey higher.
One former UN report find out say most victims na young, poor urban males and say di police, wey bin no need search or arrest warrants to conduct house raids, bin systematically force suspects to make statements wey implicate dem or risk facing lethal force.
Critics say di campaign bin target street-level pushers and fail to catch big-time drug lords.
Many families also claim say di victims - dia sons, brothers or husbands – bin just dey di wrong place at di wrong time.
Investigations for parliament bin point to one "death squad" of bounty hunters wey bin dey target drug suspects. Duterte don deny di allegations of abuse.
DI ICC bin first take note of di alleged abuses for 2016 and start im investigation for 2021.
E bin cover cases from November 2011, wen Duterte bin be mayor of Davao, to March 2019, before di Philippines withdraw from ICC.








