Wetin we know about Kendrick Lamar new album GNX

Rapper Kendrick Lamar, wear black clothes, necklace, and carry bag ova his shoulder, to perform onstage for Rolling Loud Miami 2022 for Hard Rock Stadium on July 24, 2022 for Miami Gardens, Florida

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Noor Nanji
    • Role, Culture reporter
  • Read am in 4 mins

US rapper Kendrick Lamar don release one new album wey im call GNX.

Di 12-track album, na di musician sixth studio release, im drop dis one for im social media pages around 17:00 GMT on Friday.

E feature contributions from American R&B star SZA as well as Kamasi Washington, among odas.

GNX na Lamar first album since 2022 wen im bin drop Mr Morale & Di Big Steppers, and dis dey come ahead of im headlining performance for Super Bowl halftime show for February.

E finish off an eventful year for Lamar, wey im recent music bin dey gingered by im beef wit Canadian star Drake.

Lamar (left) and Drake

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lamar (left) and Drake gbas-gbos bin trend online

Di rumour don dey ground since, say Lamar, wey don win multiple Grammys and the Pulitzer Prize for Music, dey work on one new project.

Early reviews of di album dey mostly positive, some fans enta social media to praise im new offering.

"Any oda tin wey come next, di Pulitzer Prize winner don write anoda ogbonge chapter for wetin still remain as di most interesting longform tori for hip-hop," Na wetin AP News write.

Di news outlet call Lamar "an ambitious and very talented poet from Compton wey dey work through him - and di world - contradictions on di biggest stage, wey dey forever discomforted by im crown".

Rating Game Music say di album "reminds us why im be one of di greats", but add say: "Overall, dis album no really feel like a monumental release – e dey more like a creative purge, na way for Kendrick to get a few ideas out of im system."

"My guess? Na sa di di real project dey on di horizon".

Some pipo bin dey speculate say Taylor Swift go dey, but di pop sensation no dey.

Two of dem bin don work togeda bifor, wen di rapper bin appear for Swift track Bad Blood from di album 1989.

However, na SZA voice dey for two tracks, luther and gloria.

Lamar and SZA bin recently siddon for one interview wit Harper' Bazaar, wia dem bin cover a wide range of topics from spirituality to mental health.

Oda tracks include tv off, dodger blue, peekaboo, and gnx.

For di opening track, wacced out murals, Lamar bin refer to im upcoming Super Bowl performance.

Di ogbonge show dey takes place for di middle of di NFL season finale and e dey get massive audience among Americans. However, some Lil Wayne fans no too happy dem feel say dem for pick am instead.

"I feel say my hard work let Lil Wayne down," di Compton rapper sing.

"I bin win di Super Bowl and Nas na di only one to congratulate me."

Di new album also follows a long-running fight with Drake, wey go back years, but eviritin escalate to new levels earlier dis year, as di two rappers bin insults each oda well-well inside new songs.

Di gbas-gbos bring out some huge tracks, di popular one na Lamar's Not Like Us.

Powered by an irresistible DJ Mustard beat, Not Like Us bin break Spotify records, to become di hip-hop song wit di most plays in a single day.

E go on to top di US charts, and reach number six for UK – wey make am Lamar biggest hit as a solo artist.