Trump, Biden and Obama honour former President Jimmy Carter at state funeral

Wia dis foto come from, Getty Images
Di body of Jimmy Carter don arrive in Washington DC, wia di former US president go lie in state bifor a large state funeral.
Carter bin die on 29 December at di age of 100 for im hometown of Plains, Georgia.
Dem bin first hold one funeral service for am for Atlanta on Saturday at di Carter Presidential Center, wia hundreds of members of di public come pay dia last respects.
Di largest funeral celebration for Carter dey take place for di Washington National Cathedral.
Part of di pipo wey attend apart from di past and present and future US presidents and dia partners na UN Secretary General Antonio Guterres, Prince Edward di Duke of Edinburgh and Canadian Prime Minister Justin Trudeau.
Michelle Obama bin miss dis state funeral as tori be say her schedules bin clash.
Tok-tok pesin for di former first lady, Crystal Carson tell Politico say "Mrs Obama send her thoughts and prayers to di Carter family and evrione wey bin love and learn from dis ogbonge former president".
President Biden hail Carter character
Biden start from di beginning, as e remember as e be di first senator wey endorse Carter bid for president.
Biden kon tok about wetin e learn from di former president, e even read bible passages to tok about Carter ogbonge faith.
E say, "Jimmy Carter friendship and through im life, e teach me say strength of character dey more than title or di power wey we hold. Na di strength to understand say evribodi suppose dey treated wit dignity and respect - and evrione suppose get even shot."
Biden also tok say Carter "also establish model post-presidency by say e make powerful difference as private citizen in America".
E tell pipo to study di power of Carter example as e finish say e miss im friend and thank di Carter family say dem share am wit di world.
Oda pipo wey give eulogies na Stuart Eizenstat, wey be Carter former ambassador to di European Union.
E tok say, "di test of American presidents no be di number of years wey dem serve but di rate of dia achievements. By dis measure, e mean say Jimmy Carter na one of di ogbonge one term presidents for American history".
Anoda of im grandpikin, Jason Carter tok about oga Jimmy say "for my 49 years, I neva see difference between im public face and im private one. For me na di definition of integrity be dat".
Den di former US Ambassador to di UN under President Carter, Andrew Young hail oga Carter ability to "achieve greatness by di diversity of im personality and upbringing".
Eulogies from dead pipo for President Carter
Wen you reach 100 like Jimmy Carter, e mean say you don live pass most of your colleagues, wey mean say di way dem dey memorialise di former president death dey unusual.
Many of di tori pipo wey bin write Carter obituary keep for ground don die bifor dem publish dia tori last week.
For Carter state funeral, na family members read letters from im Vice-President Walter Mondale and im 1976 presidential rival, Gerald Ford.
Ford die for 2006 and Mondale die for 2021.
Na di 38th president pikin, Steve Ford, read im papa eulogy wey im write sake of joke wia Ford and Carter gree say dem go deliver dia eulogies for dia funerals.
Steve first pay tribute to Jimmy Carter pikin dem and thank dia papa say e take care of im mama wen Ford die.
E say, "God do beta tin wen e make your papa".
Ford also make pipo laugh as im papa words yab Carter say di both of dem "marry pass dia level".
Di tribute point out say Ford and Carter friendship grow becos of dia shared experiences of family and faith and on top di fact say "life dey afta di White House".
Ted Mondale follow to read wetin Carter vice president, Walter Mondale, bin write.
Mondale describe di working relationship and say Carter na "man of im word".
E read say, "we bin dey work on real problems, not wasting time".
E bin also hail Carter stand for climate change say "very few pipo for di 1970s" bin don hear di words.
E add say, "Carter put im presidency for ground to conserve energy, deregulate new oil and gas prices and invest for clean renewable alternatives to fossil fuels. Some pipo bin tink say e dey craze to fight to pass dis laws but e bin dey right and we all know dat now".
Mondale kon praise di former president position for human rights and advancing di position of women for society.

Wia dis foto come from, Getty Images
President Carter grandson first tok about im life of service
Di first speaker at President Carter funeral na im grandson, Joshua Carter.
Joshua remember how im grandfather bin dey committed to teach Sunday School for im home for Plains, Georgia, throughout im life.
"E bin teach di Bible evri Sunday from World War II to Covid," e tok, and add: "Evri time I go church wit am, pipo dey full."
E say di church dey get many pipo from around di world, wit different backgrounds and beliefs.
Joshua say im grandfather dey begin im Sunday School teachings by talking about im week - and illustrate di remarkable life e bin live.
"If e monitor election, e go tok about am. If e stop a conflict, e go tok about am. If e eliminate disease from a village or a kontri, e go tok about am," Joshua tok.
"Wen my brother Jeremy die, e announce dat news for Sunday School."
Wetin be state funeral?
State funeral for di US na very ceremonial event wey dey mostly reserved for former president.
Dis burials dey sometimes hold for high ranking officials or military leaders but e depend on di sitting president.
Di events for am dey include Lying in State period wia dem go fly di bodi go Washington DC often for military aircraft. Dem go kon keep am for di Capitol Rotunda for few days so mourners from di public go fit come pay dia respects.
Afta words, na di state funeral service for di National Cathedral wia plenti dignitaries dey mostly among dose wey go attend.
Afta dat, di bodi go go wia dem decide to bury am. For President Carter, na for im hometown of Plains, Georgia, dem go bury am next to im wife, Rosalynn for im family peanut farm.









