Massive crowd turn up for burial of Hamas leader Ismail Haniyeh wey dem kill for Iran

Ismail Haniyeh funeral

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Thousands of pipo don turn out for di funeral procession of Hamas political chief, Ismail Haniyeh, wey bin die for one missile strike for Tehran on Wednesday.

Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, na im go lead di prayers bifor dem go bury di Hamas leader for Qatar.

US media quote Iran officials tok say di supreme leader don order a direct attack against Israel, who dem say dey responsible for di attack on Iran soil.

Israel neva comment on di assassination directly.

However, Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say im kontri don deliver “crushing blows” give dia enemies, including di killing of one senior Hezbollah commander for Lebanon.

"Since di strike for Beirut, we don dey hear threats from all sides. We dey prepared for any scenario and we go stand united and determined," Netanyahu tok for one televised address.

UN Secretary-General, Antonio Guterres don cut warning to tok say hostile situation for di region fit escalate dangerously.

Hamas armed wing on dia part say di death of Haniyeh go "take di battle to new dimensions" and e go get major repercussions.

Na di group bin attack Israel on 7 October, 2023 and kill about 1,200 pipo.

Since dat attack, Israel don vow say dem go destroy Hamas.

Here na some foto of how Haniyeh funeral dey go for Iran:

Massive crowd for Iran

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di crowd wey turn out for Ismail Haniyeh funeral for Tehran, Iran capital, dey massive
Women weep for Haniyeh funeral

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Even women follow dey mourn di late Hamas leader
Protesters burn Isreal flag during Hamas leader funeral for Iran

Wia dis foto come from, Getty Images

Protest also happen for Pakistan sake of Haniyeh killing

Wia dis foto come from, Getty Images

Ismail Haniyeh funeral, in Tehran, Iran

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di crowd wey gada to mourn Haniyeh dey massive