Hamas agree to ceasefire afta Israel say Rafah attack go happun no mata any deal

Israel-Gaza war

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Hamas leadership tok say dem don accept di terms of a ceasefire deal for Gaza.

For one statement, di group say dem don inform Qatari and Egyptian mediators of dia decision.

Dia finer details neva dey announced, including how long e go last and wetin e mean for hostages wey dem hold for Gaza.

Dis dey come afta Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say Israel go launch attack for di city of Rafah wey dey for southern Gaza, no matter di peace talk wey dey go on now wit Hamas.

Hamas official tok say di 'ball now dey for Israel court'.

For one statement wey dem publish on dia official website, Hamas tok say dia leader Ismail Haniyeh conduct one telephone call wit di prime minister of Qatar, Sheikh Mohammed bin Abdulrahman Al Thani, and wit di Egyptian intelligence minister, Abbas Kamel, and inform dem of Hamas approval of dia proposal regarding ceasefire agreement.

Pipo for Gaza dey happy

BBC take eyes see fotos of pipo for Gaza wey bin dey happy mood outside al-Aqsa hospital for central Gaza.

Children dey jump up and down as people chant joyously and bang wetin sound like pots and pans.

Israel-Gaza war

Wia dis foto come from, AP

Proposal includes 'far-reaching' conclusions Israel doesn't agree to - report

One Israeli official don tok say Hmas don approve "softened" Egyptian proposal wey no go dey acceptable to Israel, Reuters report.

Di agency also reports say one Israeli official tok say di proposal include "far-reaching" conclusions wey Israel no agree to.

Hamas statement raise hopes afta difficult tok-tok

Israel-Gazar war

Wia dis foto come from, Reuters

Hamas statement say dem accept ceasefire proposal dey come afta weeks of difficult tok-tok wey bin also involve US, Qatar and Egypt.

At dis point, e dey unclear exactly wetin Hamas accept, but in recent days, unconfirmed reports tok about one phased agreement wey go free dozens of Israeli hostages in return for a much greater number of Palestinian prisoners wey dey Israel as fighting go dey pause.

Hamas bin dey insist on complete end to di war but Israel don make am clear say na somtin wey dem no fit accept, since e go allow Hamas to survive.

Di agreement statement from Hamas dey come hours afta Israel, for the first time, order Palestinians to evacuate from part of di southern Gaza city of Rafah in preparation for one operation - a move wey fit don put plenti pressure on Hamas to prevent am.

IDF tok-tok pesin say Israel dey examine ceasefire deal

Israeli military tok-tok pesin Daniel Hagari tell one media briefing say Israel dey examinine di ceasefire proposal wey Hamas say dem don accept.

Dis na wetin im tok:

"We examine evri answer and response seriously and we dey exhaust evri possibility regarding negotiations and returning hostages.

"In parallel, we still dey operate for Gaza Strip and go continue to do so."

Netanyahu plan to invade wit or witout deal

For one meeting wit relatives of some of di hostages wey Hamas still dey hold, Netanyahu tok say im go invade "wit or witout" a deal.

Im comments come even as di US kontinu to dey warn against di invasion for Rafah unless civilians dey well protected.

According to a statement from di White House, US President Joe Biden bin tok wit Netanyahu for phone on Sunday, and e emphasize im clear position on Rafah.

Biden bin don tok say di proposed invasion of Rafah na "red line".

Israeli military personnel bin dey drop flyers for di eastern area of Rafah to tell civilians make dem evacuate ahead of a planned operation for di city.

Di flyers dey two different versions - red and blue.

For di red version, di IDF tell residents of specific areas for Rafah wia dia forces "go dey operate", and e warn say "anyone found near terrorist organisations dey endanger diasef and dia family members".

E tell citizens to move to di "humanitarian area" in al-Mawasi, and to avoid heading north of Wadi Gaza, or nearing di eastern and southern security fences.

Di blue version announce di expansion of di zone wia di IDF tok say "humanitarian aid go kontinu".

Israel/Hamas crisis

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Israeli Defense Forces (IDF) don dey drop flyers for eastern Rafah dey tell pipo make dem comot for di area.

On Tuesday, di UN Secretary General Antonio Guterres tok say attack on Rafah go be an "unbearable escalation", and e beg "all those wey get influence over Israel to do evri tin for dia power to stop am".

More dan half of Gaza 2.5m population dey for Rafah afta dem run comot from oda parts of di territory.

Conditions for di overcrowded city dey hards, and pipo wey dey stay dia bin don dey complain of lack of food, water and medication.

Palestinian President Mahmoud Abbas, on Monday tok say an invasion of Rafah go be di "biggest catastrophe for di history of Palestinian pipo".

Israeli sources tell Reuters news agency on Monday say dem go stop di plans to attack Rafah in favour of a "sustained period of calm" if Israel and Hamas fit reach agreement for a ceasefire.

Israel Foreign Minister Israel Katz bin don tok for Israeli Channel 12 television say "if deal go dey, we go suspend di [Rafah] operation".

But on Tuesday, oga Netanyahu insist say di war go kontinu until Israel don achieve all dia objectives for Rafah.

"Di idea say we go halt di war bifor achieving all of di goals dey out of di question," e tok.

"We go enta Rafah and we go eliminate di Hamas battalions wey dey dia wit or witout a deal, in order to achieve di total victory," according to one statement wey Netanyahu office bin issue.

Al-Mawasi
Wetin we call dis foto, al-Mawasi camp wia IDF ask pipo for Rafah to go to

E tok say di families of di hostages urge di prime minister and im national security adviser, Tzachi Hanegbi, to kontinu di war and ignore mounting international pressure.

However, many hostage families don publicly demonstrate for di goment to agree to a deal to return their loved ones at any cost.

About 130 hostages from among 253 kidnapped by Hamas for dia sudden attack on Israel on 7 October remain unaccounted for. At least 34 of dem dey presumed dead. Di odas don dey released or rescued.

Indirect discussion don dey for stand still for weeks now, although di US Secretary of State, Antony Blinken, on Monday tok say im hope Hamas go accept wetin im describe as Israel "extraordinarily generous offer" for a ceasefire.

Meanwhile di head of UN refugee organisation don warn say di looming invasion for Rafah don dey cause pipo for dia to dey live in a state of "constant traumatic stress disorder".

"Dem neva tell pipo to evacuate from Rafah but there is a sense say if dem no reach any deal dis week, e go fit happen," Philippe Lazzarini bin tell tori pipo.

"My colleagues for ground dey describe constant state of trauma among di pipo."

"I know say dis day go come" - Gazans for Rafah

Children in Rafah waiting to leave

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dis children dey sit for di back of a truck with dia property, waiting to leave Rafah

Meanwhile, some Gazans wey dey currently take shelter for Rafah don share dia reactions to di order by di IDF for dem to comot from di area.

One of dem, Abu Ahmed, lament say: "Di Israeli occupation bin tell pipo to go to Rafah say di area dey safe. Today, dem don dey tell us again to comot from Rafah. Wia di pipo go go? Abi make we go to di sea? Wia pipo go run go now after dem bin don tell us say dis na safe area?"

Anoda pesin wey her name na Amina Adwan tok say dem bin dey awake since 2am sake of di bombs wey dey go off every now and den.

"As we dey wake up, heavy rain dey fall, e don drown our clothes and oda items. We also dey hear anoda bad news say make we comot from Rafah. I dey call on di whole Arab world to interfere for a ceasefire - make dem interfere and save us from wetin we dey inside. We don tire," she tok.

Abu Raed na anoda refugee for Rafah wey follow BBC tok.

E say: "E don dey rain heavily and we no know where to go. I bin dey worried say dis day go come. I go now start again to see where I fit carry my family go."

Di last hope don finish - Unicef

People dey comot from Rafah

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pipo don dey flee from Rafah

One toktok pesin for di United Nation's Children's Fund (Unicef), James Elder, tell BBC Radio 4 say di order by Israel for more dan 100,000 Palestinians to comot for Rafah "na everything wey we bin dey fear".

"You dey see families wey don dey displaced multiple times, who don dey endure trauma wey pesin no fit comprehend," Elder tok.

Di Israeli military bin tok say pipo fit go to tent cities for nearby Khan Younis and al-Mawasi, wia aid go dey available.

But Elder tok say Khan Younis no be option "because na rubble", so many civilians go choose to go further north.

"But di picture for dia no dey much better," sake of raw sewage dey flow tru di streets, e tok.

"Di coping capacity of sheltering Palestinians don dey smashed. Dem no get anything else left, and yet, here they go," Elder tok.

"You just hope against hope. But that last hope don go."