Wetin don happun so far afta Iran attack Israel

Wia dis foto come from, Israeli government handout
Israeli military Chief of Staff, Herzi Halevi tell Air Force troops say dem go meet di launch of plenti missiles and drones by Iran wit response.
E tok dis one as e dey visit di Nevatim Air Base wey collect small from di Iranian attack.
Di tok-tok pesin for di Israel Defense Forces (IDF) Daniel Hagari tell tori pipo on Monday say Tel Aviv must to do evritin necessary to protect di state "for time and in way wey we for Israel chose to do am".
D wahala wey dey for front of di war cabinet now na to find how to deliver ogbonge message without say dem cause regional kasala.
Meanwhile, Iran Foreign Minister Hossein Amir-Abdollahian say im kontri attack na "exercising di right to legitimate defense" and dem no go waste time to protect dia interests for future.
Wetin Israel want?
Di Israeli war cabinet meet for di second time to discuss how dem go take ansa back di Iran attack.
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say di international community "must continue to stand united to resist dis Iran aggression wey dey threaten world peace."
Israel foreign minister say e dey lead "diplomatic offensive against Iran", as di goment dey consider military ansa to di Sunday missile and drone attack.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di foreign minister, Israel Katz don ask plenti kontris to impose sanctions for Iran missile programme.
E post for X say, "dis morning I don send letters to 32 kontris and follow plenti foreign ministers and leading figures tok to call for sanctions for di Iranian missile project."
E also say make dem call Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) terrorist organisation "as way to curb and weaken Iran".
IRGC na di most powerful branch of Iran armed forces and don claim responsibility for Saturday attack.
But for UK, di former head of MI6 Sir John Sawyers tell BBC say, "di counter-terrorism legislation dey designed to deal wit terrorist groups, e no dey designed to deal wit states.
Now, Iran na state sponsor of terrorism, no doubt, but state fit be bigger threat dan terrorist organization."

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile, di White House bin don warn Israel say US no go chook hand inside any do me I do you attack on Iran, according to senior administration officials.
Officials say Joe Biden tell Israel make dem tink dia response "carefully".
One senior administration official tell tori pipo on Sunday say oga Biden tell Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu make im "tink am well and strategically" about how dia forces go ansa dis unusual attack, wey go be di first direct attack wey Iran go land di kontri.
Why US no wan get hand for retaliation?

Wia dis foto come from, Reuters
Di official add say di Biden administration believe say Israel na im beta pass for di exchange wey start wen dem senior Iranian military commander bin dey killed for one Iran consular building for Syria.
Na about 99% of di missiles, drones and cruise missiles wey Iran send bin dey shut down or blocked, for wetin US officials dey point to as proof say Israeli military beta pass Iran own.
US aircraft and naval vessels shoot down dozens of Iranian projectiles as di attack bin dey happun. Na ova 80 drones and at least six ballistic missiles US aircraft and vessels shoot down or dey shot by air defence forces ova Iraq.
Dis include seven drones and one ballistic missile as dem bin prepare to launch from Yemen. Na wetin di US Central Command (Centcom) add for update on Sunday.

Wia dis foto come from, Reuters
Tok-tok between oga Biden and oga Netanyahu just afta di attack wey include about 100 ballistic missiles wen blood still hot, bin happun "about how to slow tins down and tink tins through" as oga Biden emphasize say, Israel "na im get di best out of am".
Di official no gree tok weda White House warn against response as dem say "na calculation wey Israeli go need make".
National security tok-tok pesin, John Kirby hala for different US television appearances say US dey clear Israel say dem no want wider kasala.
Di senior administration say dem don send di same message to Iran thrugh diplomatic channels.
Attack involve drones, cruise missiles and ballistic missiles
Iran launch more Dan 300 drones and missiles towards Israel, di Israeli military tok on Sunday.
Di attack include 170 drones and 30 cruise missiles, none of wey enter Israeli territory, and 110 ballistic missiles of wey a small number reach Israel, military spokesman Rear Admiral Daniel Hagari tok for televised statement. BBC never independently verify dis figures.
Di shortest distance from Iran to Israel dey about 1,000km (620 miles) across Iraq, Syria and Jordan.
Dem launch bombardment from several kontries
On Saturday night Iran Revolutionary Guards Corps (IRGC) say dem don launch drones and missiles.
Iraqi security sources tell Reuters say dem see projectiles dey fly over Iraq for di direction of Israel.
Di IRGC say dem fire ballistic missiles almost one hour afta di slower moving drones so dat dem go strike Israel at roughly di same time.
Di US defence department say US forces intercept dozens of missiles and drones launched from Iran, Iraq, Syria and Yemen.
Di Iran-backed Hezbollah group for Lebanon also say dem fire two barrages of rockets at one Israeli military base for di occupied Golan Heights, one plateau wey Israel don annexe from Syria in a move wey no dey recognised by most of di international community.
How many missiles go through and which damage dem cause?
For Jerusalem, BBC correspondents report say dem hear sirens and see srael Iron Dome missile defence system in operation, wey dey use radar to track rockets and fit differentiate between those wey dey likely to hit built-up areas and those wey no go hit.
dem dey fire Interceptor missiles only at rockets wey dey expected to strike populated areas.
A few of di ballistic missiles go through and strike Israeli territory, Rear Adm Hagari said.
One of dem "lightly hit" di Nevatim air force base for di Negev desert for southern Israel. Rear Adm Hagari say di base "still dey function".
Two US officials tell BBC US partner CBS news say five ballistic missiles dodge air defences and impact on Israeli territory.
Iran official IRNA news agency say di attack don deal "heavy blows" to di air base.
Four land for di base - wia di kontri F-35 fighter jets bin dey based - wey di officials say na Iran primary target.
One missile hit one runway, anoda hit one empty aircraft hangar and one hit one hangar wey bin dey out of use. Di fifth ballistic missile be like e dey aimed at one radar site for northern Israel but e miss im target.
Of di 120 ballistic missiles wey Iran fire, around half of dem failed on launch or crashed mid-flight, one of di officials tell CBS.
Iran official IRNA news agency say di attack bin deal "heavy blows" to di air base.
One seven-year-old girl bin dey seriously injured by shrapnel, Rear Adm Hagari tok. Di girl from one Bedouin Arab community near di southern town of Arad, bi dey reported say she injure afta one Iranian drone bin dey intercepted overhead. She bin dey intensive care.
Jordan also say some shrapnel bin fall on im territory "without causing any significant damage or any injuries to citizens".
Oda kontris react immediately following di attack
UK Prime Minister Rishi Sunak confam say UK RAF Typhoon jets bin shoot down some Iranian attack drones, Oga Sunak say di Iran attack na "dangerous and unnecessary escalation wey I condemn wit di strongest terms."
Jordan wey get peace treaty wit Israel but dey vex for di way dem dey run dia war against di Palestinian group Hamas for Gaza=, also block flying objects wey enta dia airspace for dia citizens safety. Dis na according to wetin Jordanian cabinet statement tok.
France help to patrol airspace but Israeli military say dme no sure weda dem shoot down any missiles.












