'E dey unforgivable' - NGO tok say Israeli air strike kill 7 of dia aid workers

Israel air strike

Wia dis foto come from, Getty Images/WCK

One charity organisation World Central Kitchen (WCK) don tok say seven of dia aid workers die for Israeli air strike for Gaza.

According to di charity organisation, aid workers from kontris wey include UK, Poland and Australia die for di attack.

WCK founder and chef José Andrés tok say dem die "for one IDF air strike". Di Israel Defense Forces (IDF) tok say dem dey conduct "thorough review".

Gaza Hamas-run media office also blame Israel.

We no fit independently verify di alleged strike immediately.

One journalist wey dey work for di BBC for Gaza don see deadi bodi of three international aid workers and one Palestinian driver, wey dem recova from di site of di alleged air strike. Dem also show foreign passports.

WCK later tok for one statement say seven of dia team don die and dem include Australian, Polish, British, Palestinian and one dual US-Canadian citizen.

"I dey heartbroken and appalled say we - World Central Kitchen and di world - lose beautiful lives today becos of one targeted attack by di IDF," di charity CEO Erin Gore tok for one statement.

"Di love dem get for feeding pipo, di determination dem embody to show say humanity rises above all, and di impact dem make in countless lives go dey forever remembered and cherished".

Ms Gore tok say WCK dey pause dia operations immediately for di region.

She tok say dose wey die na part of one convoy dey hit while leaving di Deir al-Balah warehouse for central Gaza, "where di team bin unload more dan 100 tons of humanitarian food aid bring to Gaza on di maritime route."

Ms Gore tok say dis attack no be only against WCK, but also on humanitarian organisations wey dey show up for di most difficult situations where pipo dey use food as weapon of war.

"E dey unforgivable," she add.

Further details of di alleged attack still dey emerge.

Adrienne Watson, one tok-tok pesin for di White House National Security Council, tok on X: "We dey heartbroken and deeply troubled by di strike wey kill [WCK] aid workers for Gaza.

"Humanitarian aid workers gatz dey protected as dem deliver aid wey dey desperately needed, and we urge Israel to swiftly investigate wetin happun."

Lalzawmi "Zomi" Frankcom

Wia dis foto come from, WCK

Wetin we call dis foto, Lalzawmi "Zomi" Frankcom appear for one World Central Kitchen (WCK) video last week

Australian Prime Minister Anthony Albanese don confirm say aid worker Lalzawmi "Zomi" Frankcom dey among dose wey die and e don offer im condolences to family and friends.

For one statement, e tok: "Dis na someone who bin dey volunteering overseas to provide aid through dis charity for pipo wey dey suffer tremendous deprivation for Gaza. And dis just dey completely unacceptable."

E tok say Australia dey expect "full accountability", and add say na "tragedy wey no suppose occur".

One Palestinian medical source tell di BBC say di workers dey wear bullet-proof vests wey bear WCK logo. Di charity dey currently provide meals for thousands of pipo for Gaza.

For one post on X, Mr Andrés, a celebrity chef, call on di Israeli goment "to stop dis indiscriminate killing".

Di charity recently make headlines for providing hundreds of tonnes of food for Gazans wey arrive on di first aid ship.

Commenting on di reports, di IDF say dem dey conduct thorough review for di highest level to understand di circumstances of dis "tragic incident".

"Di IDF dey make extensive efforts to enable di safe delivery of humanitarian aid, and don dey work closely wit WCK in dia vital efforts to provide food and humanitarian aid to di pipo of Gaza," dem ad.

Bifor confirmation say one Australian national die for di incident, di Australian foreign ministry tok: "We don dey veri clear say we expect humanitarian workers in Gaza to get safe and unimpeded access to do dia lifesaving work".

Di UK Foreign Office and Polish foreign ministry don dey contacted for comment.