Di Gaza paramedic wey dem kill inside im own ambulance

Mahmoud Al-Masry colleague dey comfort am afta dem kill im father on 11 October 2023

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Mahmoud (right) colleague bin dey comfort am during im traumatic moments afta e discover say dem don kill im papa
    • Author, Ethar Shalaby
    • Role, BBC Arabic

Warning: Dis tori contain graphic descriptions of deaths and injuries.

Di news come around 14:00. Paramedic Mahmoud al-Masry and di rest of im team bin dey for di al-Awda hospital for northern Gaza, wia dem bin dey wait for di next call-out.

Di despatcher bin announce say dem don hit ambulance 5-15 - Mahmoud papa team. Im be paramedic too.

Mahmoud and im colleagues rush to see wetin don happun.

Wen dem reach dia, dem see as di ambulance don turn to ordinary metal as e scatter by di roadside.

Mahmoud run go near di wreckage, but im see say evribodi wey dey inside "completely burn and tear into pieces".

One BBC Arabic documentary wey dey follow paramedics for di first month of di war capture Mahmoud reaction as e realise say dem kill im father, Yosri, and two oda crew member.

"No brightess bin remain for im face again," Mahmoud cry.

Paramedics carry one body bag from one destroyed ambulance, 11 October

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Di paramedics arrive to see say di ambulance wey destroy and three crew members don die

Na on 11 October, five days into di war.

Dem bin wrap Yosri Al-Masry lifeless body inside one white clothe, along wit im helmet wey blood stain.

For di burial, Mahmoud kneel down beside am, e dey wipe tears comot as e dey shake im head, im colleagues gada nearby.

Na journalist for Gaza, Feras Al Ajrami film dia stories for di documentary Gaza 101: Emergency Rescue.

Afta im papa death, 29-year-old Mahmoud, wey get three children of im own, take some weeks off.

But im bin tok say, even though im dey feel deep sadness, im bin wan go back to work.

"My inner drive na to serve di Palestinian pipo ," e tok.

E set di wallpaper image for im phone to show im papa face," so I fit see am, day and night".

Mahmoud father, Yosri Al-Masry, before dem kill am

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Mahmoud father, Yosri, bin also work as a paramedic wit di PRCS

Dia last moments togeda na a couple of hours bifor Yosri die. Im bin don tell Mahmoud to make am a cup of coffee, wey im drink before afternoon prayers. Small time dem call Yosri ambulance and e comot.

Only two days earlier Mahmoud bin get injury, and dem bin carry am go hospital on stretcher wit shrapnel wey dey neck and back.

Im papa bin don dey by im side cry. "Im bin dey so worried," Mahmoud tok.

But wen im tink of im father in di weeks afterwards, na di moments wey don pass by, wen dem destroy di vehicle na im tormessit alone, I relive am... I bin dey rush go towards di ambulance, I bin dey rush towards my papa, I dey shocked to see am scatter to pieces and I bin wan faint," im tok.

Mahmoud bin don dey work as paramedic for seven years, and at di time, im bin dey base for Jabalia for northern Gaza, as part of one Palestine Red Crescent Society (PRCS) team.

Di documentary follow di ambulance crews from di unit over di month following 7 October, wen Hamas launch dia attack on Israel wey kill 1,200 pipo and taking about 250 hostage - and Israel begin dia serious military response.

Paramedic Rami Khamis crying in driver's seat of ambulance

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Rami tok say as im see three girls wey dey lifeless inside one room, e remind am of im own daughters

More dan 10,000 Gazans na im dem kill for di first month, according to di Hamas-run health ministry, wey says di number don rise since risen to more dan 27,000.

Filming di paramedics close-up, as dem bin dey drive down dark alleyways and hold tight di bodies of babies wey wound, dem reveal how dia personal and professional lives overlap. E show di trauma wey dem dey face, especially wen dem need to deal wit di bodies of children.

For di first days of di war, anoda paramedic, Rami Khamis, bin break down dey crying for di wheel of im ambulance.

Im say dem bin call am to go one house wey don collapse ontop pipo wey dey live inside, wey be mostly women and children. Wen im enta di room, im see three girls wey don die for ground, e make am tink of im own three daughters.

"I no fit control myself. I burst into tears as I see dem," im tok. At di time, di footage of am wen im dey cry bin go viral.

Towards di end of October, Alaa Al-Halaby, anoda member of di team, receive call from a family member.

Dem tell am say Israeli strike hit im uncle house two days earlier, Alaa tok, but some of di pipo wey dem bin don kill still dey buried under di rubble. Dem bin pull-out im cousin body and im bin dey hope to carry m go hospital.

As im enter a narrow alleyway, wia a group of pipo bin dey try to move a pile of collapsed concrete, one of im relative tell am: "E get one girl, na either half or all of her body."

Im pause, take a deep breath, part of im face dey hide inside im medical mask, im say: "Di girl parts dey dia, put dem wit am."

Di same day, Alaa arrive for one house wia dem lay five badly burned dead pikin dem. Im direct a team as dem carry three of dem inside one plastic shroud to im ambulance.

"Di first tin wey come to mind wen you hold pikin body parts na say, you remember as you dey hold your own pikin," im later tok.

"E dey makes us…", im begin to explain. But im neva finish di sentence, as dem call am to anoda emergency.

Alaa, pictured in a medical mask, helping collect bodies from his uncle's house, 27 October 2023

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Dem bin call Alaa to come im uncle house, wia im help to collect di deadbodi of one girl wey dem don kill

One week into di war, Israel bin order civilians for Gaza north to comot go di south for dia own safety, so most of di team families park comot, while di paramedics stay.

Dem dey keep in toucch wit dia wives and children through snatched conversations for phone or over di PRCS dia radio network.

Rami don work as a paramedic for two decades, im say anytime new clash for Gaza, im daughters dey hold am tight and beg am make im no go work.

Alaa also tok say im children cry wen im go, im say im dey pray evritime as im dey drive around, asking God to "return am to dem safely".

Di risks wey PRCS staff and volunteers dey face dey clear.

In anoda incident, wen some of di paramedics bin dey wait for dia vehicle outside al-Awda hospital, one explosion wey happun make dem to scramble for cover.

At least two ambulances damage. One of di paramedics say di Israeli air strike bin target one house wey dey next to di hospital. Israel say dem no target di location but dem"strike a military target a few hundred metres away".

Di PRCS says 11 members of dia teams for Gaza na im dem don kill since 7 October.

"For evri mission, danger and risk to di lives of our teams dey," Nebal Farsakh, wey be spokeswoman for di organisation, wey dey list incidents wia dem don kill PRCS staff and volunteers tok.

"Dem dey target our crews on duty, and di conditions under wia dem dey operate dey treacherous and horrifying," she tok.

Di PRCS na non-governmental humanitarian organisation and a member of di International Federation of Red Cross and Red Crescent Societies (IFRC).

Under international law, di Red Cross and Red Crescent emblems dey recognised for marking medical and humanitarian workers, wey dey protected under di Geneva Conventions.

Paramedic carrying girl with red lights and rubble in background

Wia dis foto come from, Feras Al Ajrami

Wetin we call dis foto, Di paramedics dey rescue injured children most times

Ms Farsakh say di emblem dey marked on di top and sides of di organisation ambulances, including ambulance 5-15, di one wey dem kill Mahmoud father inside.

Di PRCS believes say di Israeli forces "directly target dem".

"E no dey possible say wit all di technology wey di Israeli occupation dey use dem go tok say dem no see am," she tok.

Di Israel Defense Forces (IDF) say dem "no dey target medical workers, including PRCS staff, intentionally".

In di case of ambulance 5-15, dem say dem "strike one military target a few hundred metres away" and di ambulance location "no dey di target".

Dem add say di "air strikes no dey usually cause casualties to di extent wey dem described".

Israel say dia operation dey target Hamas fighters, and dia military dey "take feasible precautions to mitigate civilian harm".

Di IDF dey accuse Hamas of using civilians as human shields and say dem dey hide for medical facilities. Dem don also share footage of tunnels Israeli forces say dem don discover, wey dey close to and under hospitals, as well as weapons wey dia troops don see for medical facilities.

Di Israeli military don also accuse Hamas say dem dey use ambulances - though no be specifically di ones wey PRCS dey use - to transport fighters and weapons.

PRCS say 16 of dia own vehicles no dey work again since di fight since 7 October - and say, di total across Gaza, na 59 ambulances wey don completely destroy.

Ms Farsakh say di PRCS "neva" dey subject to interference from Palestinian fighters.

"Our work for ground na to provide health and humanitarian services," she tok.

Mahmoud Al-Masry, lie down wit injury for hospital trolley, 9 October 2023

Wia dis foto come from, Feras Al Ajramy

Wetin we call dis foto, Mahmoud Al-Masry bin wound wit shrapnel for im neck and back two days before dem kill im.

"Our principles na di same as those of di International Red Cross and International Red Crescent, wey dey most importantly objective and independent," she tok. " Interference no dey from any entity or any party."

For late December, di PRCS reduce dia operations for northern Gaza afta, e say, Israeli forces bin attack di base for Jabalia.

Di IDF deny say dem open fire at or within di clinic, dem say dem "locate one cell of numerous Hamas terrorists for Red Crescent clinic, dem also some of dem wey wear Red Crescent uniforms and vests".

Ms Farsakh say "absolutely truth no dey" to di claim, and say di clinic contain only ambulance crews, volunteers, and wounded pipo from displaced families.

Alaa, Rami and Mahmoud all comot go south, and kontinu to work as paramedics for di Khan Younis area - though Rami bin recently return to di north.

For late January, as fighting begin serious around Khan Younis, Mahmoud move im wife and children - Mohamed dey 6 years, Leila, five years and Layan, 3 years- to live inside tent for al-Mawasi, one coastal desert area wey dem previously designate a safe zone by Israel.

Four months on from wen im father die, im say im commitment to helping di sick and pipo wey wunjure go still kontinu: "Dis na my papa message and I get to carry on dey do am."