Russia jet wey dey carry Ukrainian prisoners of war don crash wit 65 pipo dead

Explosion as e dey happun

Wia dis foto come from, Russian Telegram

One Russian Ilyushin-76 military transport plane don crash for area wey be di border wit Ukraine.

Russia military of defence tok say na 65 captured Ukrainians wey dem wan use do prisoner exchange for di Belgorod region bin dey inside di plane.

As at now none of di tori wey dey comot about wetin hapun fit dey independently verified.

Ria Novosti news agency say anoda nine pipo wey include six crew members bin dey inside di plane.

Ukraine general staff tok say di plane bin dey transport missiles for di Russia S-300 air defence systems. Dem no tok anytin about any prisoners of war.

But di oga of Ukraine military intelligence directorate, Andriy Yusov bin tok say dem bin dey ready to do prisoner exchange sha.

Video wey comot for social media show as di plane dey crash-land come catch fire for around 11:00 local time (08:00 GMT).

Di regional govnor for di Belgorod region for Russia, Vyacheslav Gladkov, say di plane crash for field wey dey near wia pipo dey live and evri bodi wey dey inside die.

Some Ukrainian media bin speculate say na maybe di Ukrainian forces crash di plane but dem don delete dat kain tok-tok.

Ukraine general staff tell BBC Ukraine say dem neva get correct informate about wetin happun and dem dey investigate am.

Di Ukrainian goment joinbodi wey dey incharge of prisoners of war say Russia dey "actively run special information operations against Ukraine to scata di Ukrainian society."

But for statement, di Russian defence ministry say military transport bin travel from base wey dey north east of Moscow dey go Belgorod before dem accuse Ukraine air force say dem fire two anti aircraft missiles from dia side of di border.

Dem suppose hold di prisoner exchange on Wednesday afternoon but di oga of Russia parliamentary defence committee say anoda plane bin dey air wit 80 Ukrainian prisoners but dem change cause. E add say for now plans no dey for any prisoner exchange.

Map of Russia

Ukraine and Russia don do some prisoner exchanges since di war start.

Di biggest na earlier dis month wen Ukraine release 248 Russian prisoners of war and Russia release 230 pipo for deal wey di United Arab Emirates set up.

Ova 6,000 Ukrainians, wey include both sojas and civilians dey Russa hand and tens of thousands odas dey miss, according to Ukraine Coordination HQ on Treatment of PoWs.

Dem bin announce small air raid alert for Ukraine afta di plane crash.

Belgorod wey dey 40km from di border wit Ukraine don suffer well well from air strikes and drones since di war start.

For December, 25 pipo die and 100 injure on top air strike wey Ukraine say target only military infrastructure. Dem say na Russia air defence make di fragments land for di city.

Russia bin start invasion of Ukraine for February 2022.

Last week Russia claim say dem capture one village wey dey for di Ukrainian Donesk region but Kyiv neva confam.

Russia don also increase air strikes in recent weeks as dem kill 18 pipo and injure 130 pipo on Tuesday.