Lyta new record label: Naira Marley sign Opeyemi Babatunde Rahimto MarlianMusic months afta disagreement wit Olamide YBNL Nation

Lyta new song

Wia dis foto come from, Naira Marley/Twitter

Wetin we call dis foto, Naira Marley sign Lyta
Read am in 2 mins

Lyta, wey be young Nigerian singer on Wednesday reveal say im go soon drop im next single.

Di announcement wey Lyta drop form im Instagram page land just one day afta Popular Nigerian singer, Naira Marley sign di 22 year old singer to im record label.

On Tuesday, Marley post for im Twitter page to share one picture of Lyta wit document wey appear to be a record deal, wit di caption: "Welcome to MarlianMusic Lyta."

Lyta say im dey so excited to join wetin im call im new family Marlian music and also thank Naira Marley.

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 1

Naira Marley bin launch im own label for January, 2020 MarlianMusic wen e sign four artistes—Zinoleesky, Mohbad, Cblack, and Fabian — during one ogbonge concert alias 'Marlian Fest' inside Victoria Island, Lagos.

Lyta new song

Wia dis foto come from, Lyta

Lyta music journey before e join Naira Marley marlian music

Dis dey happun just one year afta e bin join Doro Music and release im popular single, 'Monalisa,'

Lyta new song

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Lyta and Naira Marley

Tori be say Lyta wey real name na Opeyemi Babatunde Rahim, na singer and songwriter.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 2

Di Nigerian singer sign a record deal wit YBNL Nation in 2018 but e leave di label in May 2019 afta e bin get disagreement wit Olamide.

Di association no end on di best of terms as Lyta accuse legendary artist, Olamide of some questionable things. Olamide respond to Lyta inside one open letter.

Lyta release im 5-track debut EP Id in 2019 and 4 July 1998 dem bon di 22 year year old Ajegunle based singer