Naira Marley: Court don dismiss Naira Marley case wey involve assault and stealing

Niara Marley

Wia dis foto come from, Niara Marley/Twitter

Magistrate court for Ikoyi, Lagos state Nigeria don dismiss di case against musician, Afeez Fashola AKA Naira Marley.

Di chief magistrate Tajudeen Elias na im troway di mata dis morning.

Lawyer to Naira marley, Ayodeji Awokunlehin claim say all di accuse wey dem sama against di singer na lie and dem don even fix di car of di pesin wey carry di mata come court.

On top why di singer no appear for court, di lawyer say Naira Marley presently dey out of di kontri na im make am.

Di pesin wey drag Naira Marley go court, Ademola Adelekan claim say di singer assault and damage im car but im go drop di charges because di singer don meet up with im demands.