Mummy calm down boy biography: Govnor of Lagos ask pipo to learn from viral video of little Oreofeoluwa Lawal-babalola and 'calm down'

Mummy calm down viral video: Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu and boy wey trend

Wia dis foto come from, Instagram

Wetin we call dis foto, Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu dey find di boy wey don totori many with di way im sabi tok well
Read am in 2 mins

Mummy calm down viral video don make di Govnor Babajide Sanwo-Olu of Lagos to tell Lagosians (di over 22 million pipo wey dey live inside Nigeria commercial capital) to learn from di small pikin wey dey tell im mama to 'calm down' wen she be wan beat am.

Sanwo-Olu on Wednesday plead with Lagosians to do am small small during di Salah festival wey dey come and do as di little boy tok, make dem "calm down".

For inside di viral video one little boy begin dey trend on social media afta im dey cry as im mama wan beat am but im dey beg im mother make she calm down and rest well for chair.

Di govnor say di boy dey very and e sow di kind hustle wey mothers dey go through to raise children.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

In di oda message wey dey di govnor statement to Lagosian, he say as pipo dey plan to celebrate di Muslim holiday, make dey also learn from Prophet Ibrahim self-restraint as di world dey fight coronavirus.

"We need moderate our celebration and also observe protocols for coronavirus wey be to maintain social distancing, washing and sanitizing our hands, and using our face masks," di govnor say.

"I dey beg everi Lagosian to 'calm down' and make you no get carried away by di 'excitement of di moment'. Like di rest of di world, we still middle pandemic and need to remain careful to keep di gains of di sacrifices we have all made in the past months."

Goment for Nigeria don declear Thursday and Friday as public holiday for di Muslim celebration wey dey come.

Calm down boy biography: 'Im be comedian for house'

Di mother of 'calm down' boy wey don go viral for video don say di little boy na comedian for dia house.

Di boy, Oreofeoluwa Lawal-babalola, become social media sensation after she go viral from video where he bin dey tell im mother to 'calm dow '.

Di mother of di boy na Toluige Olokoobi Babalola and she tok say no be today wey di boy dey do funny-funny tins for house.

According to wetin BBC pidgin find, di mother don come open Instagram page for di boy where she don already upload new video of where she bin dey dance with di boy.

Lagos State govnor Babajide Sanwo-Olu don tok say im go like meet di boy after im use di boy as example during im salah message to lagosians.