Taiwans mourn 7 year old boy wey im older classmates and coach nack for ground 27 times during judo class

File foto of a judo class

Wia dis foto come from, Getty Images

One seven year old boy wey dem nack for ground 27 times during Judo practice for Taiwan don die.

For April, e suffer serious brain damage afta one judo class wey see im classmates and coach use am as punching bag during di practice.

Di boy wey neva dey identified later enta coma and dem put am on life support machine.

Afta nearly 70 days wen e no wake up from di coma, im parents decide to withdraw di life support.

Di boy coach wey dey in late 60s bin dey charged wit accuse of physical assault plus say e use small pikin commit di crime, according to local tori, Taiwan News.

Authorities release di coach wey dem identify only by im surname Ho earlier dis month on bail of NT$100,000 ($3,583; £2,587).

Now wey di victim don die, prosecutors go change im charge to dat of "injury wey lead to death" according to tori site Taiwan News.

If dem find am guilty, e fit face anything from minimum of seven years for jail or up to life imprisonment, di report add.

Wetin we sabi about di 7 year old boy

Judo if dem do am well no dey lead to injuries (file pic)

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Judo if dem do am well no dey lead to injuries (file pic)

Wei Wei* na normal seven-year-old boy wey dey live for Taiwan.

E be fan of Super Mario, e like sports and e bin take third position inside one track race.

For April, e bin convince im family say im wan give judo lessons a try. Just two weeks later, those lessons become di reason why e enta coma wey later lead to im death.

One disturbing video bin go viral wey show as older classmates dey throw am up and down for mat during judo practice.

As di lesson continue, dem hear as e dey shout "my leg", "my head" and "I no want!" but im coach continue to dey order am to stand up and tell di older boy to continue to dey throw am.

When Wei Wei become too weak to get up, di coach wey big pass am well-well, carry am up and throw am down several times too. At one point, di child vomit, but di "training" still no stop.

Altogether, im family say dem throw am more than 27 times.

Wei Wei finally faint and dem carry am go hospital where doctors discover say serious blood dey comot from im brain. E dey for coma and go need life support.

"I still remember that morning when I carry am go school," im mama tok.

"E turn around and tell me, 'Mama goodbye'. By night, e don become like dis."

Respect and Reverence

Taiwanese students dey expected to obey di teacher no matter what

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Taiwanese students dey expected to obey di teacher no matter what

Di seven-year old boy bin attend judo class on 21 April under di supervision of im uncle, wey according to report feem am for class to show im mama say judo no good for am.

Di video show as older classmates throw am around during practice. Di video show as e dey shout but im coach order am to stand up and tell di older boy to continue to dey throw am for ground before di coach pick am up and throw am to di ground imsef.

E later faint but di family tok say di coach say e fake di faint.

Plenty pipo don ask why di uncle no try stop dem but experts for Taiwan say plenty respect dey for teachers - wey sometimes mean say pipo must accept dia authority regardless of di circumstances.

Di boy mama tell tori pipo say wetin happun to di boy pain di uncle. Na later dem discover say di coach no get license.

Na 9pm on Tuesday, Fengyuan Hospital announce say im blood pressure and heart rate levels dey drop. Afta doctors follow im family tok, dem agree to comot am from life support.

Many pipo don tok sorry to di family on top Taiwanese social media as dem share dia pain.

Odas dey call for harsher action against di coach and for compensation to di parent of di boy.