Ime Udoka coach Boston Celtics: US Basketball team name Nigerian star Ime Udoka new coach

Ime Udoka

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, 43-year-old Ime Udoka go become Celtics 18th Head Coach for di Franchise History.

Boston Celtics, American professional Basketball team don appoint Nigerian-American as dia new coach.

Celtics formally confirm Ime Udoka appointment on Monday afternoon.

Udoka wey be former basketball player dey take over Brad Stevens role.

Di club been promote Stevens to di team president of basketball operations to replace Danny Ainge.

43-year-old Ime Udoka go become Celtics 18th Head Coach for di Franchise History.

Udoka join Celtics franchise afta im spend di last nine NBA seasons as assistant coach.

As assistant coach im don dey wit San Antonio (2012-13 to 2018-19), Philadelphia (2019-20), and Brooklyn (2020-21).

Teams wey Udoka don serve as an assistant coach don qualify for di playoffs in all nine seasons.

One of those years im team win di NBA championship (Spurs, 2014).

"Na honor to dey part of di historic Celtics franchise. To Coach dis talented roster and work alongside Brad make sense," na so Udoka tok.

"I'd like to thank Wyc, Steve, and Brad for trusting me wit dis opportunity. I dey look forward to start right away."

Udoka wey dem born for US-born go become di first Nigerian-American to dey appointed as head coach for NBA.

Im represent Nigeria for international competition throughout im playing career, winning bronze medals for 2005 and 2011 at the African Championships.

Boston Celtics don announce former Nigerian Basketball player Ime Udoka as dia new head coach.

Dis na everything you need to know about how dem pick Udoka and im basketball career.

Who be Ime Udoka?

Ime Udoka coach Boston Celtics: US Basketball team name Nigerian star Ime Udoka new coach

Wia dis foto come from, Boston Celtics

Wetin we call dis foto, Ime Udoka

Udoka father from Akwa Ibom state for south-south Nigeria.

Im play for Nigeria National Team for di 2005 FIBA African Championship, where im help di team win bronze medal.

For di final game, Udoka score 24 points to help Nigeria defeat Algeria 88-76.

Im continue to play for di team, and help Nigeria qualify out of di group stage for 2006 FIBA World Championship.

Udoka still win more accolades wit Nigerian National Team. For 2011 e win another bronze medal for di AfroBasket, afta di team defeat Ivory Coast 77-67.

Ime Udoka in action for Nigeria at the 2006 World Championships

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ime Udoka represent Nigeria for di 2006 World Championships

Udoka coaching experience

Udoka don dey NBA as an assistant coach for nearly ten years, majority of dat time e spend am working under his former head coach for San Antonio, Gregg Popovich.

Afta seven seasons for NBA and di time wey im spend playing UCAM Murcia CB in Spain for 2012, Udoka return back to Spurs for 2012 as an assistant coach. Him bin dey part of di staff for2014 when dem beat di Heat to capture di NBA championship.

Udoka bin join di staff of di 76ers for di 2019-20 campaign na from dia im move go Nets for di start of di 2020-21 season.

Ime Udoka

Wia dis foto come from, Getty Images

Udoka playing career

Udoka waka well-well across di world during im playing career.

Di 6-foot-6 forward, play collegiately wit San Francisco and Portland State and played one season wit Club Sportivo Independiente, one Argentinian basketball team for di Liga Nacional de Basquet.

Den for 2002 dem draft am into di NBA Developmental League wia im spend one season wit North Charleston and make brief appearance wit Lakers for 2004 e play four games and averaged two points.

Di next two seasons, 2004 and 2005, e spend am for Europe, first e play for Gran Canaria in Spain and eventually e join JA Vichy for France.

Im go through di NBDL Draft again for 2005 and wia Fort Worth Flyers take am third before im reach di NBA again for 2006 wit di Knicks, where im average 2.8 points.

Im best season na for 2006-07 when im started 75 games for diTrail Blazers and averaged 8.4 points, 3.7 rebounds and 1.5 assists.

Im play di next four campaigns for San Antonio, where im average 4.5 points, 2.7 rebounds and 0.8 assists per game for 160 games, na only three im start.

Udoka last bus stop na for Spain wit UCAM Murcia CB for 2012 before im retire as player.