Ejura protest shooting of youth: 'Kaaka alleged murder' - What we know of Ghana #Fixthecountry campaigner death plus Ejura clash

Ibrahim Kaaka Mohammed

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we call dis foto, Ibrahim Kaaka Mohammed - Di demonstration happun right afta di burial of Kaaka, in accordance wit Islamic custom.

Ghana Ashanti Regional Police Command don begin investigate Ejura protest alleged murder

Police want to establish di circumstances wey surround di violent clashes between di youth and security personnel.

Di clashes lead to di death of two and injury of four plus a Military Lieutenanat for Ejura, Shanati region on Tuesday.

For inside statement, di Assistant Superintendent of Police, Godwin Ahianyo say:

Di investigation wey dem carry out reveal say di incident happun afta di burial of Ibrahim Mohammed Kaak for Mempeasam cemetery for Ejura.

"Some Ejura youth bin block road to cause traffic, while police move in wit military reinforcement to quell di situation.

"But di Irate youth charged on di security officers wit all manners of implements wey include firearms, clubs, matches and stones". De police statement add.

Ejura protest shooting of youth: How e happun

Ghana joint police and military security team allegedly shoot four youths wey dey demostrate for Ejura, Ashanti region on Tuesday.

Youths for di area bin dey demonstrate ontop di murder of one #FixTheCountry campaigner Ibrahim Muhammed, popularly known as Kaaka.

According to reports from local tori pipo from PulseGhana, dem don rush di victims to di Ejura Government Hospital for medical treatment.

Di demonstration happun right afta di burial of Kaaka, in accordance wit Islamic custom.

According to one eyewitness account, di shooting start afta di agitated youth start dey burn tyres and destroy property. Pulse report.

Meanwhile, Deputy Director of Communication of di governing New Patriotic Party, Joyce Zampare, don speak on Kaaka alleged murer.

Zampare say di death of di #FixTheCountry campaigner no get anythin to do wit President Nana Akufo-Addo stranglehold on free speech.

Some unknown pipo bin attack Ibrahim on Friday, June 25, 2021, dem hit im head until he become unconscious.

Dem later rush am go hospital.

Ejura protest shooting of youth: Wetin kill Kaaka?

Di attack on Kaaka wey also be member of di Economic Fighters League happun on Saturday morning

He die a day afta while im dey receive treatment for di Komfo Anokye Teaching Hospital.

Di activists of di #FixTheCountry say dem go seek audience wit di Inspector General of Police on di matter.

Dem add say dem no go rest until dem get justice for Kaaka.

Ejura protest shooting of youth: Police make arrest

Meanwhile police say don arrest two pipo in connection wit di killing of di campaigner

De Ashanti Regional Police Public Relations Officer, ASP Godwin Ahianyo announce say:

De witness accounts show say dem Ibrahim Muhammed in front of im house wen im bin dey returning home on im motorbike at about 1:30 am on Sunday, June 27, 2021.

Dem arrest de suspects on Monday following police intelligence.

Ejura protest shooting of youth: Ghanaians dey bore

De death of two protesters for Ejura inside Ashanti Region after some youth clash plus police and military today dey bore Ghanaians.

De clashes which happen sake of de youth dey protest de murder of me young man for Ejura leave four people plus injuries.

Death of 40 year old Ibrahim Mohammed popularly known as Kaaka outrage de youth who hit de streets to protest for justice.

Dem storm de community police station to question security officials on how dema investigations dey go.

In de course of dema protest, de police and military team cross de youth for town to control de protest.

Videos which start dey go viral show as security officials dey fire weapons which eventually kill two protesters.