Beji Caid Essebsi: Tunisia go swear in Speaker Ennaceur to replace late President Essebsi

Wia dis foto come from, AFP
Tunisia go swear in di speaker of dia parliament, Mohamed Ennaceur as acting President afta dia presido die dis morning.
Late President Beji Caid Essebsi die for hospital and di Prime minister don declare seven days of mourning.
Tunisia first democratic elected president, Beji Caid Essebsi die at di age of ninety-two. E die for hospital but officials no tok wetin dey sick am.
Before Essebsi die, politicians and social media users don dey demand to know wetin dey worri im health since im first land hospital last month.
Tori pipo Reuters say dem carry di 92-year-old go hospital on Wednesday July 24, according to wetin di presido pikin tok.
Na di third time wey President Essebsi bin dey sick in matter of weeks. For June ending, im bin dey hospital afta "very serious crisis", officials bin tok dat time but dem no give more details of wetin dey worry am.

Wia dis foto come from, AFP
Di presido wey be di oldest sitting presido for world bin no make any official comment about im health.
Essebsi bin win Tunisia first free elections for 2014 afta di Arab spring katakata for di region.
End of Di one wey oda users dey read well well
Early dis year, im announce say im no go contest for elections wey go happen for November to allow anoda younger pesin take charge.











